Prosperity, reverse jakpa, economic freedom and mourning full New Year prophecies by men of God for Nigeria and Ghana

Adeboye, Olukoya, Nigel, Owusu Bempah, Uche

Wia dis foto come from, ADEBOYA/OLUKOYA/GAISIE/OWUSU BEMPAH/BOAHEN UCHE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Nigeria and Ghana go face issues, US, Russia and Germany also go suffer even though good tins go also happun
Read am in 5 mins

Na dat time of di year again – Christians around di world cross ova into di new year 2026.

Even as most pipo get dia own expectations for di new year, prophets and preachers also get wetin dem say "God reveal to dem about Nigeria, Ghana and oda kontris for di world."

As millions of Christians enta di new year wit church service and oda activities, dem gat to take note of some of di tins dia prophets tok say go happun for di world dis year 2026.

For Ghana, even though di Police Service wey don warn pastors "against causing fear and panic" wit dia prophecies in di past, some notable pastors continue dia ritual of 31 December watchnight service prophecies.

But dis be some of wetin ogbonge pastors tok for dia crossover service.

Pastor Enoch Adeboye (Redeemed Christian Church of God (RCCG)

Pastor Enoch Adeboye

Wia dis foto come from, PASTOR ENOCH ADEBOYE/RCCG HQ

Wetin we call dis foto, More breakthroughs, more successes, more victories go happun dis year - Adeboye

Di general overseer for di Redeemed Christian Church of God (RCCG) share some of di prophecies wit im followers.

  • More breakthroughs, more successes, more victories go happun dis year
  • Pipo go get plenty testimonies
  • Strong wind go continue to blow around di world
  • Hunger go reduce for Nigeria
  • Small & medium businesses go flourish
  • Reverse jakpa; many pipo wey jakpa go begin return to Nigeria
  • Chance of major war for di world go dey low dis year
  • Weather go dey like wetin happun 2025 except couple of hurricanes wey go happun

Prophet Daniel Olukoya (Mountain of Fire and Miracles Ministries International (MFM Int'l)

Daniel Olukoya during service

Wia dis foto come from, DANIEL OLUKOYA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Surprises go full dis year – good ones for good pipo and bad ones for bad pipo

Di general overseer for di Mountain of Fire and Miracles Ministries International (MFM Int'l) during crossover service also drop tins wey go happun dis year in di life of pipo, di kontri Nigeria and di world.

  • 2026 be fast, strange and troublesome year
  • Surprises go full dis year – good ones for good pipo and bad ones for bad pipo
  • Many believers go witness strange and mysterious lifting
  • God go empower strong evangelists to thrive
  • Kontris wey dey righteous go witness di hand of God
  • Na bad year for traitors and disloyal pipo
  • Year of tragedy for unfaithful married pipo

Bishop David Oyedepo (Living Faith Church Worldwide)

Bishop David Oyedepo

Wia dis foto come from, BISHOP DAVID OYEDEPO/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "We don enter our year of rest for Nigeria dis year" - Oyedepo

Di founder and presiding Bishop of di Living Faith Church Worldwide wey many pipo sabi as Winners' Chapel make prophetic declarations for im members and followers.

  • No tears for members throughout 2026
  • Curses dey removed
  • Sickness-free year for followers
  • We don enter our year of rest for Nigeria dis year
  • Di church of Christ go dey unstoppable

For Ghana, three popular men of God release controversial prophecies as dem dey do am every year.

Apostle Dr. Isaac Owusu Bempah - Glorious Word Power Ministries International

owusu bempah

Wia dis foto come from, APOSTLE DR ISAAC OWUSU BEMPAH/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "Attempted coup and chaos for Ghana parliament"

He tok im followers to intercede and pray to stop di bad tins wey im see say go happun to prominent and popular pipo, di kontri Ghana and oda kontris for di world.

  • Death around prominent pipo – former presidents, boxers, journalists and chiefs
  • Attempted coup and chaos for Ghana parliament
  • Confusion for di opposition party wey go select ex-vice president Dr Bawumia as dia flagbearer
  • Ghana go prosper and pipo go get moni for dia pocket
  • Nigeria, US and Russia gatz to pray to avoid death around dia seat of govment

Prophet Nigel Gaisie - Prophetic Hill Church

PROPHET NIGEL GAISIE

Wia dis foto come from, NIGEL GAISIE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "Ghana go see progress, economy go grow" - Nigel Gaisie

Prophet Nigel Gaisie wey be one of di pastors wey dey release watchnight prophecies for Ghana continue di tradition.

  • Ghana go see progress, economy go grow
  • Italy, US and oda kontris gatz to pray to avoid attacks on dem
  • Ivory coast go suffer coup and dem go get military instability
  • Di Fifa World Cup for US go dey under threat – sometin fit make dem postpone am
  • Blackstars go shine for di World Cup and dem fit reach finals
  • Some ministers for di govment go dey under serious attack

Prophet Eric Boahen Uche - Reign House Chapel

Prophet Uche during watchnight service

Wia dis foto come from, PROPHET ERIC BOAHEN UCHE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, "Dem go force President John Mahama to stand for third term" - Prophet Uche

Many celebrities and stars dey visit Prophet Uche; in fact during di watchnight, many of dem wey be gospel musicians perform for di service. E later release prophecies for 2026:

  • Death of popular footballer, men of God, boxer, parliamentarians, musician and former president of di kontri
  • Dem go force President John Mahama to stand for third term
  • Zimbabwe and South Africa go suffer from drought, energy crisis and water shortage etc
  • Arab kontris go rise against each oda. Kenya go witness more protests. President of a kontri go resign from office
  • World Cup go suffer security issues for US; Spain go win am and di era of Messi and Ronaldo go end
  • Burkina Faso president Ibrahim Traore go dey under attack