Australia announce new pathway for migration to di kontri

Sign post wey say welcome to Australia

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Australian government say dem dey look for ogbonge talented migrants from all ova di world wey go come live and work for dia kontri.

Di kontri announce dis informate as dem launch one new visa - Di National Innovation visa (subclass 858). Dis new pathway go allow migrants and dia families to come live permanently for Australia.

Di National Innovation visa dey replace di Global Talent visa wey end for 6 December.

According to di government, dis new visa na part of one big strategy "to attract exceptionally talented individuals wey fit drive growth in sectors of national importance. These migrants go help create jobs and drive productivity growth in key sectors of di economy

"NIV dey find established and emerging leaders wey get high-calibre of talents and skills wey fit make significant contributions wey go benefit Australia future prosperity," di Ministry of Home Affairs tok.

Di ministry add say di category of migrants wey dem dey look for na global researchers, entrepreneurs, innovative investors plus athletes and creatives.

Who dey eligible for di National Innovation visa

To dey eligible for dis visa, di ministry must invite you, dat na wen you go fit apply for di visa.

Di applicant must also be pesin wey dey recognised on international level for ogbonge achievement, and e must dey nominated by pesin wey get national reputation.

Di applicant must be pesin wey dey very popular all ova di world weda for im profession, sport, arts, academia and research.

Dis one mean say, e must get superior abilities plus achievements wey pass oda pipo own, pipo must know say e dey excellent for im area of practice, plus e must get record of sustained achievement wey nobody go fit break or match in di near future.

On di mata of age, applicants of any age fit apply for di visa. Di koko na say, weda you be under 18-year-old, or you don pass 55 wen you apply, you must dey beneficial to di Australian community.

Wit dis visa, goment say applicants go fit;

  • Stay for Australia permanently
  • Study and work for Australia
  • Enrol for Australia public health care scheme
  • If eligible, apply for Australian citizenship