'We go overcome dis unacceptable terrorism and banditry' and oda tins Tinubu tok for Nec conference

Wia dis foto come from, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu/Facebook
Nigeria President Bola Tinubu don declare say di kontri go defeat terrorism and banditry as e describe di security threats as "unacceptable".
President Tinubu yarn dis one on Monday 9 February wen e declare open di Second National Economic Council (Nec) Conference for di State House Conference Centre, Abuja.
Di President assure Nigerians of im administration resolve to strengthen di kontri security forces and restore peace across affected communities.
"I promise you here say I go play my part. Seven zones of mechanisation dey come. I promise Nigerians say dis go dey delivered, and I dey here again to further find ways to strengthen our security forces and defeat terrorism," Tinubu tok.
Di President say na wetin don give evribodi sleepless night, but assure Nigerians say "we go win wit determination and resilience".
"We go overcome dis unacceptable terrorism and banditry. E no dey part of our culture. E dey foreign to us," e tok.
President Tinubu assurance dey come days afta suspected Boko Haram terrorists storm Woro Community for Kaiama Local Govment Area of Kwara State, north central Nigeria, and kpai ova 100 pipo.
In recent times, Nigeria don begin record increased number of violent, terrorist attacks for north central Nigeria.
For many years, bandits and Boko Haram terrorists don mostly target pipo for northeast and northwest of Nigeria, but recently, dem don begin move enter oda parts of di kontri, including Kwara and Niger states wey don record several attacks in recent months.
Di President describe insecurity as economic hindrance and say all hands gatz dey on deck to find immediate solution.
Di conference na two-day conference themed "Delivering Inclusive Growth and Sustainable National Development: Di Renewed Hope National Development Plan 2026–2030".
Dose wey bin dey in attendance include Vice President Kashim Shettima, state govnors, ministers, members of di National Assembly, development partners and private sector leaders.
"I dey pleased to address di second edition of di National Economic Council Conference for critical moment for Nigeria development journey. Nec remain a cornerstone of fiscal federalism and economic governance for our kontri," e tok.
Monetary policy and infrastructure
President Tinubu say di economic reforms wey im administration don undertake since 2023 don help stabilise di economy and restore confidence.
"I gatz say again at dis juncture, di monetary policy wey we don embark on don yield positive results and gain recognition around di world," e tok.
E commend di Central Bank of Nigeria under Govnor Yemi Cardoso for restoring confidence in Nigeria monetary policy.
President Tinubu say im administration don prioritise infrastructure development across transportation, power, digital connectivity, housing and irrigation.
E also highlight expanded social investment and human capital programmes targeting vulnerable households, youth, women and small businesses, alongside grassroots-focused initiatives under di Renewed Hope Agenda.
"Di Renewed Hope Ward Development Project further demonstrate our commitment to grassroots inclusion through a bottom-up approach to national development.
"Dis successes reflect strong collaboration among di federal and state govments, development partners and di private sector," e tok.
President Tinubu tell di conference say while di task bifor di nation dey challenging, di opportunity dey historic.
E express confidence say resolutions from di conference go advance agricultural diversification, including dairy farming, livestock investment and ranching.










