Turkey to train Nigeria Special Forces against Boko Haram and oda highlights of President Tinubu visit to di kontri

Bola Tinubu shaking Recep Tayyip Erdoğan

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X

Read am in 6 mins

Turkey don announce new economic, trade and defence cooperation agreements wit Nigeria.

Dis dey come afta one state visit by Nigeria President Bola Tinubu to di Republic of Turkey.

For one joint press conference wit President Tinubu on Tuesday, 27 January, Turkey President Recep Tayyip Erdoğan tok say both kontris don agree to pursue a five-billion-dollar trade volume target.

Dis na some of di key highlights of President Tinubu visit to Turkey.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Fight against terrorism

Turkiye President President Recep Tayyip Erdoğan and Nigeria President Bola Tinubu. Erdoğan wear blue shirt and blue jacket, while Tinubu wear white shirt, yellow tie and grey jacket.

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/X

Turkish President Recep Erdogan give assurance say im kontri go support Nigeria fight against terrorism.

For di joint press conference, e express readiness to deepen cooperation in military training and intelligence.

"We stand wit di friendly pipo of Nigeria for dia fight against terrorism. We don evaluate opportunities for close cooperation, especially concerning military training and intelligence," di Turkish president tok.

E add say Turkey ready to share significant experience in dia fight against terrorism wit Nigeria govment.

Di Turkish president tok say terrorist groups, particularly in Africa Sahel region, pose a threat to di continent stability.

Nigerian officials also hold meetings wit Turkey leading defende industry firms during di visit and express confidence say di outcomes of dose toks go dey positive.

President Tinubu say di military assistance go extend beyond Nigeria to di wider region, wey dey face different security challenges.

Nigeria dey face multiple security crises, wey include attacks by jihadist groups, mass abductions and kidnappings for ransom by armed gangs wey pipo sabi well-well as bandits, plus violence wey dey linked to criminal gangs and separatist groups.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Turkey reaffirm commitment to $5bn trade target wit Nigeria

Nigeria and Turkey president and officials sign bilateral agreements

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/X

During di press conference, President Recep Tayyip Erdogan also announce new economic and trade agreements wit Nigeria.

E say im kontri dey target $5 billion trade volume wit Nigeria and add say discussions to make dis possible don already start.

"We see say we harbour important potential for di areas of trade and investments. During our meetings today, we reaffirm our commitment to di five-billion-dollar trade volume target and discuss di steps we go take," e tok.

However, e neva dey clear yet wetin di full framework of di trade target go involve or di timeline to achieve am.

At present, di trade volume between di two nations dey about $2 billion. Turkey dey export planes, helicopters, machinery, iron and steel, and chemical products to Nigeria. While Nigeria dey export crude oil and agricultural products to Turkey, tok-tok pesin to President Tinubu, Bayo Onanuga, tok for statement.

President Erdogan say di establishment of di Joint Economy and Trade Committee between di two kontris go create opportunities to expand Turkish investments in Nigeria to realise di target.

Cooperation in education

On education, di Turkish leader say wit di initiation of di Maarif Foundation activities in Nigeria, dem go fit provide additional contributions for Nigeria young population.

"Wit di agreement on cooperation in education we sign today, we go further strengthen di contractual basis of our cooperation," President Erdoğan add.

President Bola Tinubu stumble and fall

Nigeria President Bola Tinubu dey "in great shape" afta e fall for one reception ceremony for Turkey, one of im aides tok.

73-year-old Tinubu, bin dey welcomed by im Turkish counterpart for one official ceremony for di capital, Ankara, wen e stumble.

Afta e waka past one line of sojas and dignitaries, pipo fit see Tinubu on di official video of di Turkish president X account as e dey move to di right wen e stumble and fall.

Di video briefly show as pipo gada help di president bifor e cut to aerial shot and 45 seconds later Tinubu and Erdogan dey seen next to each oda.

Tinubu appear unhurt and one of im aides Sunday Dare, tok say e dey able to continue wit di bilateral meeting.

Video clips of di incident don spread on social media.

One tok-tok pesin for di president, Bayo Onanuga, later say Tinubu bin step on one metal object "for ground, wey make am lose im balance".

"Dis no be big deal, except for dose wey wan make trouble out of small incident. Na just stumble, tank God, no be fall," e add.

Di last time wey di president fall for public, bin happun for June 2024, e bin use am as joke, say na dance im bin dey dance.

For dat time, one of im aides bin describe di incident as a "mild misstep," and plenty pipo express sympathy for Tinubu, including from leading opposition politician Atiku Abubakar, wey call am "unfortunate incident".

Nigeria and Turkey sign nine agreements

Nigeria President Bola Tinubu tok say at di end of di bilateral meeting, di two kontris sign nine agreements across defence, education, media, diaspora policy, trade, social development, and institutional cooperation between dia foreign ministries.

Di agreements na:

  • Agreement on Cooperation in di Field of Diaspora Policy between di Republic of Türkiye , Ministry of Culture and Tourism, Presidency for Turks Abroad and Related Communities and di Nigerian Diaspora Commission
  • Agreement on Cooperation for di Field of Media and Communication between di govment of di Republic of Türkiye and di govment of di Federal Republic of Nigeria.
  • Cooperation in di Field of Higher Education between di Republic of Türkiye and di Federal Republic of Nigeria.
  • Joint Declaration Establishing di Economy and Trade Joint Committee; and Agreement for di Field of Halal Quality Infrastructure.
  • Cooperation between di Republic of Türkiye, Ministry of Foreign Affairs, Diplomacy Academy and di Federal Republic of Nigeria, Ministry of Foreign Affairs, Foreign affairs academy.
  • Cooperation Between di Republic of Türkiye, Ministry of Social services and di Federal Republic of Nigeria, Ministry of women Affairs and Social Development.
  • Agreement on Defence Cooperation between di Republic of Türkiye and di Federal Republic of Nigeria

Nigeria and Turkey don maintain close diplomatic ties ova di years.

President Erdoğan bin visit Nigeria for 2021.

Both kontris na members of di Organisation of Islamic Cooperation (OIC) and di D-8, one development cooperation group wey also include Bangladesh, Egypt, Indonesia, Iran, Malaysia and Pakistan.

Turkey don expand dia presence across Africa in recent years, strengthening dia influence through military cooperation, drone technology, education, humanitarian projects and cultural engagement. Dem don position diasef as alternative partner to Western powers on di continent.