Ogbonge Indian politician Ajit Pawar die for plane crash

Ajit Pawar

Wia dis foto come from, Anshuman Poyrekar/Hindustan Times via Getty Images

Read am in 4 mins

Ajit Pawar, deputy chief minister of India western state of Maharashtra, don die for plane crash along wit four oda pipo.

Di cause of di crash neva dey officially confirmed.

Pawar political career span decades and e serve as di deputy chief minister of Maharashtra several times.

Prime Minister Narendra Modi dey among dose wey don express shock and grief at di news of di crash.

Police say dem don take bodies of pipo wey die for di plane crash to di hospital.

"One expert team dey present for di crash site," Superintendent of Police Sandip Singh Gill tell reporters. "We go provide update afta di bodies don dey identified."

One eyewitness wey no wan tok her name tell ANI news agency say di plane wey carry Pawar and four oda pipo crash just bifor e reach di runway for Baramati airport.

She tok say afta rescue pipo quench di fire, local pipo see one burnt bodi inside di plane wey don scata.

She add say police later ask di locals make dem bring blanket take cova di bodi.

Till now, pipo still dey wait for official statement on wetin cause di crash.

Pipo dey pour tributes for Ajit Pawar from different political sides for India.

"E no possible to put into words how Ajit Pawar dedicate imsef for more dan three and a half decades to di welfare of evribodi for Maharashtra," Home Minister Amit Shah write for X.

Opposition Congress party leader Rahul Gandhi describe Pawar death as "veri heartbreaking".

Maharashtra Chief Minister Devendra Fadnavis say e get "no words to express my emotions".

"I don lose my strong and generous friend," e post for X.

Sanjay Raut, one top politician from di state opposition Shiv Sena (UBT) party, call Pawar di "backbone" of di state and say im death na "black day" for di political and social life of di state.

"Witout Dada [meaning elder brother for Marathi language], di political scene of Maharashtra no complete. E get open heart and evri party worker admire am," e tok.

Pawar and four oda pipo die for plane crash for Baramati earlier today. Pawar dey travel from Mumbai to Baramati to hold meetings ahead of coming local govment elections for di city.

Prime Minister Narendra Modi write for X say e dey "sad" about di news of di crash.

"My thoughts dey wit all di pipo wey lose dia loved ones for di crash. I dey pray for strength and courage for di families wey dey mourn for dis time of deep pain," e write. For anoda post, e also pay tribute to Pawar.

Maharashtra to observe three days of mourning

Pawar home state Maharashtra don declare three days of official mourning following di tragic death for plane crash earlier today.

During dis period, flags across di state go fly at half‑mast and govment offices and schools go remain shut. Officials say all public events don dey cancelled as mark of respect.

Di mourning period reflect di state recognition of im long service and influence for di state politics.

Who be Ajit Pawar?

Pawar, wey be nephew of ogbonge politician Sharad Pawar wey establish di Nationalist Congress Party (NCP), na influential politician for Maharashtra.

Im political career last many years and e don serve as deputy chief minister of Maharashtra several times.

Few years ago, e break away from im uncle party wit some lawmakers and form im own party, wey India Election Commission later officially recognise as NCP.