Who be Andrea Preti wey ogbonge Tennis player Venus Williams marry?

Wia dis foto come from, Alessandro Levati/Getty Images for Dsquared2)
Marriage fotos of veteran Tennis player Venus Williams and her Italian partner wey also be model, Andrea Preti dey fly upandan for social media.
Venus Williams confam her marriage to her partner, Andrea Preti for her official Instagram account.
Di tennis star post say "Mr. & Mrs. Preti a dream come true Part 2: My looks for di week"
She post di wedding pictures for her Instagram page too as pipo begin congratulate her.
For di wedding fotos, Venus Williams wear different wedding dress wey be like say di wedding hapun for different venues.
But di one wey catch eyes pass na di one wey she and her husband and friend snap for tennis court.
Venus Williams dey 45 years and tori say Andrea Preti dey 37 years.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Tennis great, Serena Williams na one of di pipo wey drop emotional message for Venus as dem celebrate wit her.
Serena Williams for her Instagram handle, share wedding foto wey she snap wit Venus.
"My sister's keeper. Venus, wia I go even begin? From di backyard courts to di biggest stages for di world, you dey always lead wit grace, strength, and a heart bigger dan any trophy. To watch you step into dis next chapter surrounded by love feel like say I dey watch di sun rise…steady, powerful, and full of promise.
You be my built-in best friend, my protector, my teacher, and my reminder to always waka in purpose. To see as you happy like dis, to see say you dey loved, you dey dis radiant… e mean evritin to me.
To love, to partnership, to laughter, and to a lifetime of choosing each oda evri single day. I couldn't be prouder to stand beside you, not just today, but always."
Serena Williams marry since 2017 and from her message na big tin for her to see her sister marry almost nine years later.
Oda pipo send congratulations to Venus for her page.
Venus Williams and Andrea Preti profile
Venus Williams na American professional tennis player. She be di elder sister of Serena Williams.
Venus bin don win 49 WTA Tour–level singles titles, wey include seven majors.
She win five of her majors for Wimbledon and two US Open titles.
She also win gold medal for di 2000 Sydney Olympics.
Venus records plenti well-well especially for di tennis doubles wia she bin win 22 titles, wey include14 majors and three Olympic gold medals.
She become professional player for 1994 and she reach her first major final wen she bin dey 17 years for di 1997 US Open.
Between 2000 and 2001, Venus don win Wimbledon and US Open titles plus di Olympic singles gold for di Sydney Olympics.
She first reach di singles world No. 1 ranking for February 2002 wia she become di first African American woman to reach dat ranking for di Open era.
She also set record as di second of all time after Althea Gibson.
Between 2002 and 2003, Venus reach four major finals back to back but she dey always lose to her sister Serena.
Plenti tori no too dey about her husband but according to im IG page, Andrea Preti na Italian actor. Im also be model and writer.









