Natasha Akpoti, Labubu, Achalugo - wetin Nigerians Google most in 2025

Foto of Natasha Akpoti, Labubu, Muhammadu Buhari and Bambam Olawunmi-Adenibuyan

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFP via Getty Images, Mike Kemp/Getty Images, Natasha H Akpoti/Faceboook and Bammybestowed/Instagram

Read am in 4 mins

Google Year in Search don release dia lists of wetin Nigerians search for in di year 2025.

Dem publish di lists for each categories on dia website on Thursday, di lists show how Nigerans go Google to search for tori about politics, names of celebrities, politicians, songs, cooking recipes, electronic devices and every oda tins wey dey hapun for Nigeria and globally.

Among di list na di names of Nigerian lawmaker Senator Natasha Akpoti, Labubu doll, Achalugo from di movie 'Love In Every Word', Mr Eazi - singer wey marry Billionaire Femi Otedola daughter Temi Otedola among odas.

Di death of former President Muhammadu Buhari, Diogo Jota, and Charlie Kirk top di list of di news related issues wey pipo search for 2025. While Iphone 17 and Club World Cup also top wetin pipo search under news related issues.

However, Senator Natasha Akpoti dey among pipo wey Nigerians search pass for Google in di year 2025.

Her name dey among di list of big political issues and news.

Di Kogi Central lawmaker mata wit Senate President Godswill Akpabio, gada dey among wetin pipo bin search for.

Nigerians also use Google well-well to understand news about politics for Israel-Iran war and US Election.

From big politics topics to trendy entertaining issues like 'Labubu', Achalugo, To Kill a Monkey, among odas, Nigerians search for trendy topics on Google as e dey hot to keep demselves informed and entertained in di year 2025.

Nigerians search for trendy words like, nepo baby, Ozempic, and many odas just to understand wetin e mean.

Di new iPhone 17 dey among di new devices wey Nigerians search for pass 2025, pipo also search for devices like Tecno Pop 10, Straw and Redmi 14C and Pop 10.

Gospel music Oluwatosin (Jesus Is Enough) by Tkeyz Ft. Stevehills, top di list of di trendy songs wey Nigerians search pass for 2025, afta am na Fido Joy Is Coming, Davido and Omah Lay song With You, Shallipopi song Laho and My Darling By Chella Mp3 Download.

For local and foreign movies, Nigerians search To Kill a Monkey, Squid Game, Wednesday, and Bon Appétit, Your Majesty, Straw Movie, Love In Every Word, Sinners, G20 Movie, among odas pass.

Pipo also search for popular recipes to help dem cook beta food inside kitchen.

By categories- Wetin Nigerians Google di most in 2025

News

  • Club World Cup
  • Diogo Jota
  • Buhari
  • Charlie Kirk
  • Iphone 17

Pipo (Nigerians)

  • Natasha Akpoti
  • Eberechi Eze
  • Fubara
  • Chika Ike
  • Mr Eazi

Pipo (Global)

  • Gyokeres
  • Garnacho
  • Joao Pedro
  • Aaron Pierre
  • Tyler Perry

Pipo (Sports)

  • Gyokeres
  • Garnacho
  • Xavi Simons
  • Sesko
  • Mbeumo

Pipo (Artistes)

  • Aaron Pierre
  • Chika Ike
  • Juma Jux
  • Mr Eazi
  • Kemi Adetiba

Pipo wey die

  • Diogo Jota
  • Buhari
  • Charlie Kirk
  • Pope Francis
  • Hulk Hogan

Words and dia meaning

  • Achalugo Meaning
  • Allegedly Meaning
  • Labubu Meaning
  • Kelebu Meaning
  • Demure Meaning

Question

  • Who be Charlie Kirk
  • Who be Seyi Vodi
  • Who be The New Pope
  • Who be Tompolo
  • What be Labubu

Recipes

  • Pornstar Martini Recipe
  • Ginger Shot Recipe
  • Chinchin Recipe
  • Sausage Roll Recipe
  • Hummus Recipe

Lyrics

  • With You By Davido Ft Omah Lay Lyrics
  • Oluwatosin Lyrics
  • Xxxtentacion Hope Lyrics
  • Joy Is Coming Lyrics By Fido
  • Favour It Surrounds Me Like A Shield Lyrics

Songs

  • Oluwatosin (Jesus Is Enough) Tkeyz Ft. Stevehills
  • Joy Is Coming By Fido Mp3 Download
  • Davido - With You Ft. Omah Lay
  • Shallipopi - Laho
  • My Darling By Chella Mp3 Download

Series

  • Wednesday Season 2
  • Squid Game
  • Squid Game Season 2
  • Bon Appetit Your Majesty
  • Koleoso

Movies

  • Straw Movie
  • Sinners
  • Love In Every Word
  • To Kill A Monkey Movie
  • G20 Movie

Devices

  • Iphone 17
  • Tecno Pop 10
  • Pop 10
  • Straw
  • Redmi 14c