How Tiktok reunite twins wey dem sell afta dia mama enta 'coma' just afta she born dem

Amy and Ano na identical twins, but just afta dia mama born dem, dem bin take two of dem and sell dem to separate families. Years later, dem discover each oda by chance sake of a TV talent show and a TikTok video.
As dem come dey check dia past, dem realise say dem follow for thousands of babies in Georgia wey pipo bin tiff from hospitals and sell dem. Some of dis thing even happen as at 2005. Now dem don dey ask questions.
Amy dey waka up and down for one hotel room for Leipzig. "I dey scared, really scared," she tok, as she dey fidget nervously. "I never sleep dis week. Dis na my chance to finally get some answers about wetin happen to us."
Her twin sister, Ano, sidon on top armchair, dey watch TikTok videos for her phone. "Dis fit be di woman wey bin sell us," she tok, as she roll her eyes.
Ano gree say she dey nervous too, but only sake of say she no know how she go react and whether she go fit control her anger.
Dis na di end of a long journey. Dem don travel from Georgia to Germany, wit hope say dem go find di missing piece of di puzzle. Dem go finally meet dia real mama.
For di past two years, dem don dey reason wetin happen. As dem dey find out di truth, dem come dey realise say e get thousands of oda pipo for Georgia wey dem also tiff from hospital as babies and sell dem ova di decades. Despite say some pipo don try to investigate wetin happen, goment neva hold anybodi to account yet.
Di tori of how Amy and Ano take discover each oda start from wen dem dey 12 years old.
End of Di one wey oda users dey read well well
Amy Khvitia bin dey for her godmother house near di Black Sea dey watch her favourite TV programme, Georgia's Got Talent. E get one girl wey dey dance to di gbedu, and di girl look like her. Not just like her, in fact, identical.
"Everybodi dey call my mama dey ask her: 'Why Amy dey dance under anoda name?'" she says.
Amy mention am to her family but dem brush am off. "Everybodi get doppelganger," her mama tok.
Seven years later, in November 2021, Amy post video of herself wit blue hair as she dey pierce her eyebrow for TikTok.
Two hundred miles (320km) away for Tbilisi, somebodi send di video give her friend, a 19-year-old Ano Sartania. Di friend think say "e dey cool say she look like me".
Ano try to trace di girl wey pierce her eyebrow online but she no fit find her, so she share di video for dia university WhatsApp group make e see somebodi fit help. Somebodi wey know Amy see di message and connect dem for Facebook.
Amy instantly know say Ano na di girl she bin dey seen all those years for Georgia's Got Talent.
"I don dey look for you tey tey!" she message am. "Me too," Ano reply.

Wia dis foto come from, AMY KHVITIA
Ova di next few days, dem discover say dem get plenty things in common, but evrytin bin no make sense.
Dem born both of dem for Kirtskhi maternity hospital - wey no longer exist - for western Georgia but dia birth certificates show say dia birthdays dey some weeks apart.
Dem no fit be sisters, talkless of twins. But similarities plenty.
Dem like di same music, dem both like dancing and even get di same hairstyle. Dem discover say dem get di same genetic disease, a bone disorder called dysplasia.
E just be like say dem dey unravel a mystery together. "Every time I learn something new about Ano, things dey get more strange," Amy tok.
Dey plan to meet, and one week later, as Amy dey approach di top of di escalator for Rustaveli metro station in Tbilisi, she and Ano see each other face to face for di first time.
"E just be like say I dey look myself for mirror, di same face, same voice. I be her and she be me," Amy tok. She know immediately say dem be twins.
"I no dey like hugs, but I hug her," Ano tok.

Dem decide to confront dia family and for di first time dem sabi di truth. Dem dey adopted, separately, a few weeks apart for 2002.
Amy vex and she feel say her whole life na lie. "Na crazy story," she tok. "But na true."
Ano too bin vex and para for her family "but I just want make we finish di difficult conversation so dat we go move on".
As dem dey dig deeper, di twins find say di details for dia birth certificates, including di date dem born dem, dey wrong.
As she no fit born pikin, Amy Mama tok say a friend tell her say e get an unwanted baby for di local hospital. She gatz pay di doctors but she go fit carry di baby home and raise her like her own pikin.
Ano Mama bin tell di same tori.
Di two families bin no know say di girls na twins, and even though dem pay plenty money to adopt dia daughters, dem say dem no know say e dey illegal. Georgia bin dey go through a period of turmoil and as e be say hospital staff dey involve, dem think say e dey legit.
Both family no gree reveal how much money dem pay.
Di twins diasef dey always wonder whether dia real mama and papa bin sell dem for profit.

Amy wan search for dia real mama to find out, but Ano no too dey sure. "Why you wan meet di pesin wey fit don betrayed us?" she ask.
Amy find one Facebook group wey dey help to reunite Georgian families wit children wey dem tif and illegally adopted, and she share dia story.
One young woman for Germany come reply, she tok say her mother bin born twin girls for Kirtskhi Maternity Hospital for 2002 and even though dem tell am say di pikin dem die, now, she get doubts.
DNA tests reveal say di girl from di Facebook group na dia sister, and she dey live wit dia real mama, Aza, for Germany.
Amy dey desperate to meet Aza, but Ano no too dey moved. "E fit be say na dis person sell you, she no go tell you di truth," she tok. But she sha agree to go to Germany with Amy to support her.
Di Facebook group wey di twins bin use, Vedzeb, mean "I'm searching" for Georgian. Di group get plenty posts from mothers who tok say hospital staff bin tell them say dia baby bin die, but dem later find out say the death no dey recorded and dia children fit still dey alive.
Oda posts na from children like Amy and Ano, wey dey look for dia real mama and papa.
The group get more dan 230,000 members and e get access to DNA websites. Di thing don blown open a dark chapter for Georgia history.
Na one journalist, Tamuna Museridze, set up di group for 2021 after she discover say she dey adopted. She bin find her birth certificate wit incorrect details when she dey clear di house of her mama wey die.
She start di group to look for her own family, but di group don expose a baby trafficking scandal wey affect tens of thousands of pipo, and don last for decades.

Tamuna don help to reunite hundreds of families, but she neva track down her own.
She discover a black market for adoption wey stretch across Georgia and wey don dey happen since early 1970s to 2006.
She believe say na organise criminals dey run am and e involve pipo from all sections of society, from taxi drivers to pipo wey dey high up for goment. Corrupt officials na dem dey fake di documents for the illegal adoptions.
"Di scale no dey imaginable, dem tif up to 100,000 babies. E dey systemic," she tok.
Tamuna tok say she calculate dis figure by counting di number of pipo wey don contact her and combining it wit di time frame and di nationwide spread of cases.
As access to documents no dey - some don dey lost and dem no dey gree release di others - e dey impossible to verify di exact figure.
Tamuna tok say many parents bin tell her say when dem ask for di dead bodi of dia pikin, dem go tell dem say dem don already bury am for di hospital there. Na later she find out say dem no dey get any cemetry for any hospital for Georgia. Some of di parents, dem go show dem deadi bodi of pikin wey don already freeze for mortuary.

Tamuna tok say e dey expensive to buy pikin, about 1,000 maneti ($1,400; £1,100) for a girl and 1,500 maneti ($2,100; £1,600) for a boy - wey be about one year salary for Georgia. She discover say some of di children end up with foreign families for US, Canada, Cyprus, Russia and Ukraine.
In 2006 Georgia change dia adoption legislation and strengthen anti-trafficking laws, wey mak illegal adoptions dey more difficult.
Anoda pesin wey dey look for answer na Irina Otarashvili. She bin born twin boys for one maternity hospital for Kvareli, we dey just below di Caucasus mountains for Georgia, in 1978.
Di doctors bin tell am say di boys dey healthy but, for reasons wey dem no tell her, dem keep di boys away from her.
Three days after, dem tell her say di boys suddenly die. A doctor tok say dem get respiratory problems.
Irina and her husband no fit make sense of it, but especially in Soviet times "you no fit question di authority" she to. She gaz believe everytin dem tok.

Di doctors tell dem to bring a suitcase to take di deadi bodi of di infants to go and bury for for cemetery or their back garden, as e dey common for babies at the time. Di doctor tell dem make dem no open di case as e go pain dem well well if dem see di bodies.
Irina do wetin dem tell am, but 44 years later her daughter Nino find Tamuna's Facebook group and start to dey suspect.
"What if our brothers no die true true?" she dey wonder. Nino and her sister Nana decid to dig up di suitcase.
"My heart dey beat fast," she tok. "Wen we open am, we no see bones, na only sticks. We no know whether to laugh or cry."
She say di local police confirm say wetin dey di suitcase na branches from a grape vine and e no get any trace of human remains.
She now believe say her brothers fit still dey alive.

For di hotel for Leipzig, Amy and Ano dey get read to meet dia real mama. Ano say she don change her mind and she wan back out. But she later take a deep breath and decide to go ahead.
Dia real mama, Aza, dey wait nervously for anoda room.
Amy open di door and Ano follow am, she almost push her sister enter di room.
Aza rush forward and hug dem tightly, one twin for each side. Minutes pass and dem still hug each other, nobodi tok.

Tears dey come down from Amy face but Ano no even too send. She even look a little irritated.
Di three of dem sidon to tok for private.
Later, di twins tok say dia mama explain say afta she born dem, she enta coma, and wen she wake up, di hospital staff tell her say di babies die short time afta she born dem.
She tok say meeting Amy and Ano don give her life new meaning. Although dem no dey close, dem still dey in touch.
For 2022, Georgia goment launch investigation into historic child trafficking. Dem tell BBC say dem don tok wit more dan 40 pipo but di cases dey "very old and historic data don dey lost".
Journalist Tamuna Museridze tok say she bin share information but di goment neva tok wen dem go release di report.
Dem don make at least four attempt to get to di bottom of wetin happun.
Dis include one investigation for 2003 into international child trafficking wey lead to a number of arrests but na only little information dem don make public.
And for 2015, afta anoda investigation, Georgia media report say dem arrest di general director of Rustavi maternity hospital, Aleksandre Baravkovi, but dem later clear am and e return to work.
The BBC approach di Georgia Interior Ministry for further information on individual cases but dem tell us say dem no fit release specific details due to data protection.
Now, Tamuna don join forces with human rights lawyer Lia Mukhashavria to carry di cases of a group of victims go Georgian courts. Dem dey ask for di right to access dia birth documents - something wey no dey possible currently under Georgia law.
Dem get hope say dis go help lay ghosts to rest. "I bin dey always feel like e get something or someone wey dey miss for my life," Ano tok. "I bin dey dream about a little girl wey wear black wey dey follow me around and ask me about my day." Dat feeling don disappear since she find Amy.














