Alabama perform di first US nitrogen gas execution on Kenneth Eugene Smith

Kenneth Eugene Smith

Wia dis foto come from, ALABAMA DEPARTMENT OF CORRECTIONS

Wetin we call dis foto, Kenneth Eugene Smith dey face execution over a 1988 murder

Alabama don execute di first convicted murderer, Kenneth Eugene Smith, wit nitrogen gas.

Dis na di first time dem dey use dis method of capital punishment for US.

Smith, 58, bin lost two final appeals for Supreme Court plus one for di federal appeals court, wey bin argue say execution na brutal and unusual punishment.

Alabama bin try but fail to execute Smith wit lethal injection for 2022.

Court find am guilty for 1989 for killing one pastor wife, Elizabeth Sennett, for one killing-for-hire.

According to di Death Penalty Information Centre, Smith na di first pesin wey don die by using pure nitrogen gas anywia for world.

Five members of di media na im dem transport inside van go Holman Correctional Facility for Atmore to witness the execution.

"Dis night, Alabama don cause humanity to take one step backwards," Smith tok, according to pipo wey witness am. "Thank you for supporting me. Love all of you."

Afta di gas begin to flow enta im mask, tori be say di prisoner smile, nod im head towards im family, come make di sign "I love you".

Witnesses observe say im bin dey struggle for two to four minutes and im breath heavily for about five minutes before dem announce say im don die at 20:25 local time (02:35 GMT).

Elizabeth Sennett, dem kill her for 1988

Wia dis foto come from, WHNT/CBS

Wetin we call dis foto, Elizabeth Sennett, dem kill her for 1988

Wen pesin breath nitrogen witout oxygen e dey cause di cells for di body to break down and dis go lead to death.

Alabama Governor Kay Ivey, wey bin no ansa our request to attend di execution, confam say Smith don die for one statement.

"Afta more dan 30 years and attempt after attempt to game di system, Smith don ansa for im horrible crimes," she tok.

"I pray say Elizabeth Sennett family go receive closure afta all dis years wey dem struggle wit dis big loss."

Attorney General Steve Marshall say dis don prove say e be "effective and humane method of killing", as im deny di "critical predictions" of activists and media.

"We don serve justice," im statement add.

Alabama corrections Commissioner John Hamm say di shaking wey Smith bin dey shake bin be like say na reflex movements.

"We bin dey expect all dat and follow for di side effects wey we been see or research on nitrogen hypoxia," Hamm tok.

"Notin bin dey out of di ordinary from wetin we bin expect."

Alabama bin tok for one court filing before say, dem dey Smith to lose consciousness inside seconds and die in a matter of minutes.

How Kenneth Eugene Smith land for prison

Smith mugshot di time wey im commit di offence

Wia dis foto come from, WHNT/CB

Wetin we call dis foto, Smith mugshot di time wey im commit di offence

Smith na one of di two men wey dem convict say dem murder one 45-year-old Sennett for March 1988 ontop $1,000 (£790) killing deal.

Dem execute John Forrest Parker, wey be Smith fellow hitman for 2010.

Smith confess for court during trial say im bin dey dia wen dem kill di victim but say im no follow among di pipo wey do di attack.

Di female victim (Sennett) chop beaten for di hand of her attackers wit fire appliances and stabbing for chest and neck. Dem come stage her death like say her home bin dey invaded and burgled.

Na her husband wey dey owe debt bin setup di killing as im dey try collect insurance money ontop her death. Di husband wey be preacher quickly kill imsef as investigators dey find evidences.

Na Smith and Parker dem arrest for di incident.

Dis no be di first time wey dem go try execute Smith. Two years ago, Alabama bin try to execute Smith through lethal injection but dem dey unable to raise im vein bifor di death warrant bin expire.

Why dem wan use Nitrogen gas execute Kenneth Eugene Smith

Alabama and two oda US states bin approve di use of nitrogen hypoxia as alternative method for execution becos say di drugs wey dem dey use for lethal injections don dey more difficult to find.

Di state Attorney General Steve Marshall don already tok say di use of nitrogen to execute na “di most humane method of execution wey dem ever invent".

Smith don dey death row since 1996 and di lawyer tell BBC on Wednesday say dem dey lodge anoda appeal wit hope say dem fit get last minute waiver.

To breathe pure nitrogen without oxygen go cause di cells to break down and e go lead to death. Alabama say dem dey expect say di nitrogen go make am lose consciousness within seconds and im go die within minutes.

Some medical professionals don reject dis kain method of death sake of say e fit cause different effect wey include violent convulsion, but e be like say Alabama no go back down.

Di spiritual adviser to Smith, Reverend Jeff Hood, go dey present for di room wia di execution go happun even though im believe say im life go dey in danger but im wan risk am for im calling.

Na since 2018 Alabama don dey responsible for three careless attempts at lethal injection wey di inmates bin survive.

Alabama get one of di highest per capita execution rates for di US and dem get 165 pipo wey currently dey on death row.