PSG sama Inter 5-0 to win dia first ever Uefa Champions League title

Luis Enrique dey for di back of one of im staff as e hold di European Cup for air

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Luis Enrique dey for di back of one of im staff as e hold di European Cup for air
Read am in 4 mins

Paris St-Germain don make history as dem win dia first ever Uefa Champions League title.

PSG flog Inter Milan wotowoto to lift di trophy as di match end 5-0.

Acraf Hakimi score di opening goal for di 12th minute.

Desire Doué score two gaols for di 20th and 63rd minute. Kvaratskhelia score for di 73rd minute while Mayulu score foe di 86th minute.

Di centre referee show Inter Milan mercy as e blow di final whistle for 90 minutes, e no even add extra time.

PSG coach Luis Enrique na di man of di moment as e lead a young team to make history.

Na historic night for Paris St-Germain as dem becom European Champions for di first time.

Inter Milan wey bin don win di title three times no fit play anytin for di match at all.

PSG Coach Luis Enrique na di man of di moment as e win dia first ever Uefa Champions League title

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, PSG Coach Luis Enrique na di man of di moment as e win dia first ever Uefa Champions League title

Wetin di coaches bin tok bifor di final

Foto collage of PSG Captain Marquinhos wey wear navy blue jersey and Inter Captain, Lautaro Martínez wey wear all -white jersey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Foto collage of PSG Captain Marquinhos and Inter Captain, Lautaro Martínez

Luis Enrique wey be PSG coach tell Uefa .com say : "We don grown well-well dis season and di players don make progress well-well too. I tink di strength of di team na di most important tin.

You learn sometin evriday afta many years of experience as coach, and I dey improve evritime wit dis group.

"Wetin dey ginger me na to win di Champions League for di first time wit Paris. I want dis as a gift for di team, for di club, for di city.

My team know how to unpick teams like dis and how to get dat tight-knit defence to break up. I dey very optimistic."

Simone Inzaghi wey be Inter coach tok say: "Di players dey determined to win; dem no dey obsessed, we no want dat. We dey proud to be Inter. I bin don dream of playing di Champions League final; I no do am as a player, but I thank dis group of players, na dia second time my in three years as a coach.

"We need to face Paris knowing say moments wey we go suffer go dey and oda moments wen we go get di ball and dem go need to defend go dey too. Details and moments dey important."

Head to head

For di France Ligue 1 table PSG win di league while Inter Milan finish 2nd for Serie A.

Inter Milan and PSG don meet six times for all competitions.

PSG win three, Inter Milan win two and dem draw one.

PSG don will all dia last six matches for all competitions while Inter win four out of dia last six matches for all competitions.