Wetin we know about di Liverpool FC victory parade incident wia one man drive enta crowd
Authorities don arrest one 53-year-old man after car hit some pedestrians for Liverpool city centre during di Premier League victory parade.
Eyewitnesses and videos wey circulate for social media show di vehicle as e drive enta crowd as people dey scate.
Police say dem no dey treat di incident as terror-related.
Details still dey come out, but dis an wetin we know so far.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin happen?
One car jam pedestrians for Water Street just after 18:00, Merseyside Police tok.
Inside one statement, di force say: "Dem contact us just after 18:00 today, Monday 26 May, following reports say one car hit pedestrians for Water Street.
"Di car stop for di scene and dem don detain one male."
Police later say dem arrest one 53-year-old white British man from di Liverpool area and say dem believe say e be di driver.
Di ambulance service say dem carry 27 people to hospital for treatment, with two, including one child, wey dey seriously injured.
Dem treat 20 people for injuries for di scene.
Four children dey among di injured.
Four people including one child bin dey lifted from under di car, Merseyside chief fire Nick Searle tok.
Police say dem no dey treat di case as terror-related and dem believe say di incident no relate to anoda one.
UK law define terrorism as action wey dey designed to influence di government, or to intimidate di public, for di purpose of "advancing political, religious, racial or ideological cause".
Wetin di witnesses see?
Video from di scene show as di car enta inside one group of pipo bifor e speed up and later stop.
Oda videos show as pipo dey hit di car bifor e later stop, di back windscreen of di car don break finish.
Plenty emergency service vehicles arrive di scene.
One eyewitness, BBC reporter Matt Cole, tok say im see di car as e dey enta di crowd and "di car no gree stop".
E say na some group of men bin dey chase am "dem dey bang di side and throw tins for di motor".
E reason say di car dey travel "more dan 20 [mph]".
E say im initial assumption na say di driver just wan "drive through di crowds as dem no wan wait".
Anoda witness, Matthew O'Carroll, 28, from Runcorn, tok say im see di car as e dey approach top of Water Street.
E say di car bin dey go "decent" speed and di driver bin dey horn as e dey drive through di crowd.
Wia di incident happun
E happun for Water Street, near di Strand. Bifor di incident occur, Liverpool FC bin parade dia Premier League trophy from di top of one bus.
Thousands of pipo bin come out to celebrate di team victory. Di incident happun about one mile bifor di parade finishing point.
Wetin pipo don tok?
Prime Minister Sir Keir Starmer dey updated on di latest developments.
E post on X: "Di scenes for Liverpool dey shocking - my thoughts dey wit all di pipo wey dey injured or affected.
"I wan thank di police and emergency services for dia swift and ongoing response to dis shocking incident."
Conservative leader Kemi Badenoch tok say di fotos dey "deeply worrying".
"My thoughts dey wit everybody wey dey affected, plus di emergency services as dem respond to wetin be like a horrific incident," she tok.
Liverpool FC tok say im don reach out to di police and dia "thoughts and prayers dey wit those wey dis serious incident affect", rivals Everton FC share di same sentiment.
Liverpool tok for statement: "Our thoughts and prayers dey wit those wey dis serious incident affect. We go continue to offer our full support give di emergency services and local authorities wey dey deal wit dis incident."
Reports say dem don postpone Liverpool staff celebrations sake of dis incident.
Di Premier League too don release statement, dem say, "everyone for di Premier League dey shocked by di sad events for Liverpool dis evening, and our heartfelt thoughts go out to everyone wey dey injured and affected.
"We don dey in contact wit Liverpool FC and don offer our full support following dis serious incident."
Liverpool City Region Mayor Steve Rotherham tell BBC say di incident don overshadow a day of "absolute celebration".
E ask di the public to avoid speculation and allow police to continue dia investigation.










