UK govment dey consider to remove former Prince Andrew from royal line of succession

Andrew Mountbatten-Windsor for di picture wear Order of di Garter robes for im broda, King Charles III coronation for 2023 for di Westminster Abbey

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Richard Wheeler
    • Role, political reporter
    • Author, Nick Eardley
    • Role, political correspondent
  • Read am in 5 mins

UK govment dey reason to bring up legislation wey go comot former Prince Andrew Mountbatten-Windsor from di line royal succession.

Defence Minister Luke Pollard tell BBC say dis move (wey no go allow Andrew to bicom King at all) na di "right tin to do" no mata wetin comot from di current police investigation against am.

As at now, Andrew wey be di King brother still be di eight in line to di throne even though dem don comot all im titles including Prince from am for last October. Dat one come from pressure on top im relationship wit paedophile financier Jeffrey Epstein.

On Thursday evening, authorities release Andrew under investigation, 11 hours afta dem arrest am for suspicion say im do misconduct for public office. E don continue to strongly deny say im do anytin wrong.

Speaking on BBC Radio 4's Any Questions programme, Pollard confam say govment dey work wit Buckingham Palace on plan to comot di former prince from "potentially being one heartbeat away from di throne".

E say dis na "sometin I dey hope say go get cross party support, but e dey right say sometin go hapun only afta di police investigation finish".

Chief Secretary to di Treasury James Murray tell BBC say, "any questions for diat circle go dey complicated" as e had say di live police investigation need to "play out".

On Saturday, plenti unmarked police cars bin dey enta di Royal Lodge wia Andrew bin live for many years.

Thames Valley Police wey arrest am dey expected to continue to dey search di Royal Lodge till Monday, na wetin BBC don gada.

Oda police forces across di UK dey also consider weda to start investigations, Dis na according to Danny Shaw wey be former adviser to ex-home secretary Yvetter Cooper.

Shaw tell Radio 4 Today programme say, "e dey in danger of going out of control", e come add say, e fit make di invesigations take "considerable time".

Di govment proposal to remove Andrew from di line of succession dey come afta some MPs wey include di Liberal Democrats and SNP signal dia support for dat kain legislation.

Some Labour MPs wey dey critical of di monarchy tell BBC say dem no sure say di move dey necessary bicos e no dey likely say di former Duke of York go eva go near di throne.

For October, Dowing Street say e no get plans to bring law wey go change di line of succession.

Historian David Olusoga tell BBC Newsnight say now, "desperate desire dey for inside govment and within di palace to draw firewall.... between di crisis and di wider monarchy."

Buckingham Palace neva tok openly on govment plans to comot Andrew from di line of succession.

Graphic wey show di royal line of succession after King Charles III - 1. William, Prince of Wales, 2. Prince George of Wales, 3. Princess Charlotte of Wales, 4. Prince Louis of Wales, 5. Prince Harry, Duke of Sussex, 6. Prince Archie of Sussex, 7. Princess Lilibet of Sussex, 8. Andrew Mountbatten-Windsor, 9. Princess Beatrice, 10. Sienna Mapelli Mozzi, 11. Athena Mapelli Mozzi, 12. Princess Eugenie, 13. August Brooksbank, 14. Ernest Brooksbank

How dem dey change di British royal line of succession

Di move need act of Parliament wey go need to dey approved by MPs and peers and go come to effect wen di King give royal assent.

E go also need to dey supported by di 14 Commonwealth kontris wia Charles III na head of states wey include Canada, Australia, Jamaica and New Zealand.

Di last time wey dem use act of Parliament to take change line of succession na for 2013 wen di Succession to the Crown Act bin pipo wey dem comot becos dem marry Catholic.

Dem also comot di rule wey dem dey call "male primogeniture" wey mean say, younger son fit bounce elder daughter comot di line of succession. Dat law come into commission for pipo wey dem born afta 28 October 2011.

Di last time dem use act of parliament to comot pesin from di line of succession na for 1936 wen dem comot former Edward VIII wen e comot di throne.

Andrew bin step back from public duties for 2019 wen kasala burst afta one BBC Newsnight interview abut im relationship wit Epstein.