Andrew lose im 'prince' title and go comot from Royal Lodge

Prince Andrew bust picture

Wia dis foto come from, Max Mumby/Indigo/Getty Images

Read am in 3 mins

Prince Andrew go loose im "prince" title and go comot im Windsor mansion wey dem call Royal Lodge.

Na Buckingham Palace release dis informate say di King "don start a formal process today" and dem go now call im Andrew Mountbatten Windsor.

Di Palace say dem also don "serve formal notice to surrender di lease" for Royal Lodge.

But e no go dey homeless as e dey go start di royal estate for Sandringham, Norfolk.

Dis na even though Andrew still dey deny di accusations wey dem pile for im head but di Palace say even though "dis censures dey seen as necessary."

Na earlier dis month Andrew bin give up im oda royal titles wey include di Duke of York.

Andrew dey face accuse from late Virginia Giuffre say im sleep wit her three separate times wen she be teenager.

Im don deny di accuse.

Di fact say Andrew dey lose im titles no go affect im pikin dem.

Princess Eugenie and Princess Beatrice go keep dia titles.

Dis na in line wit King George V Letters Patent of 1917.

One Historian and Author wey write di book on Prince Andrew wey di title na "Entitled: The rise and fall of the House of York" say "dem don finally get ahead of di tori but no be di end of am".

E tell di BBC say di Palace dey "finally take some decisive action" but e "no go reach to fully satisfy di public wahala".

Di author say na "big humiliation" for Andrew.

E dey understood now say not only Andrew go comot di Royal Lodge but im ex-wife Sarah Ferguson go also lose access to di mansion and go need go find wia she go stay.

Di 66 year old former Duchess of York na di mama of im two pikin and even though dem divorce for 1996, dem still be padi wey dey stay di same house.

But she give up her Duchess title dis month wen Andrew drop im own.

Why na now dem wan comot 'Prince' from Andrew?

Na almost six years since Andre interview for BBC Newsnight wey make am step back for im royal duties for 2019 so why na now dem dey comot im prince title.

Well, for dat Newsnight interview, Andrew say e cut any link e get wit paedophile Jeffrey Epstein afta dia picture for New York for December 2010.

But for January 2025, emails comot wey show say dem bin still dey yarn afta dat time. One wey dem believe say Andrew bin send to Epstein for February 2011 say, "keep for close contact and we go play again soon!!!"

For October 2025, di Mail on Sunday add say na Andrew send am true-true and even allegedly add say "e be like we dey dis tin togeda and we go need rise above am".

Na still dis month, Andrew gree to give up most of im titles like Duke of York although e still stay as Prince.

And den di book afta di death of Virginia Giuffre comot wit more details about her accuse against Prince Andrew., including di one wey she say dem nack three sperate times wen she be teenager. E deny all di accuse.