Court remand Ice Prince for Ikoyi prison over assault charge

Ice Prince

Wia dis foto come from, Lagos police & IceprinceZamani

One magistrate court sitting for di Ajah area of Lagos don order di remand of Nigerian rapper, Ice Prince Zamani for di Ikoyi Correctional Centre.

Police for Lagos on Friday arrest di popular artist ontop accuse say e assault one officer and threat to throw am inside river after e arrest am for driving without plate numbers.

Di police charge am to court and sama am three-count charge of assault, obstructing a policeman from carrying out his statutory duties and abduction.

Ice Prince plead not guilty to di charge.

Magistrate Taiwo Oyaniyi come grant am bail in di sum of N500,000 and gats also provide di court with two responsible sureties.

Di Magistrate order make e go chill for di correctional center until e fulfill im bail condition.

Dem adjourn further proceedings in di case till 7 September.

Wetin police say Ice Prince do

On Friday 2 September, police for Lagos gbab Ice Prince wey im real name na Panshak Henry Zamani.

Di Lagos command toktok pesin Benjamin Hundeyin reveal di arrest inside one tweeet for in verified Twitter handle on Friday morning.

Hundeyin say dem go arraign di musician today for allegedly assaulting and abducting one police officer.

Inside di tweet wey don get one over one thousnad retweets under one hour, police allege say Ice Prince bin kidnap, assault one police officer wey stop am for driving without license plates.

Hundeyin also accuse say di rapper threaten to throw am in di river.

''At 3am today, @Iceprincezamani dey stopped for driving without license plates.

E gree make dem take am to station. E, thereafter, abduct di police officer for im car, assault am and threaten to throw am in di river. E don chop arrest and go dey arraigned today.'' E tok.

No comment dey from di musician side yet.

Nigeria law say police fit charge suspect for ‘serious assault’ if di pesin assault, resist or willfully obstruct police officer from doing im job.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

IGP draw ears for Nigerians against assault on police officers

Di Inspector-General of Police, IGP Usman Alkali Baba, on 29 Ausugut Monday, condemn di recent trend of assault on police officers and men in uniform.

E say di officers and men wey dey carry out official and lawful duties in various locations across the nation, wen some dey attacked.

CSP Olumuyiwa Adejobi wey be di Force toktok pesin inside one statement, di attack on Police Officers,dey both illegal and an affront on di rule of law.

E warn say dem no go tolerate attacks on police officers and men in the line of duty.

According to di statement, di IGP don direct all Police Commands and Formations to ensure say dem make individuals wey engage in assault on police officers, irrespective of preceding factors to face di full wrath of di law via swift prosecution in courts of competent jurisdiction.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Wetin to know about Ice Prince

Ice Prince

Wia dis foto come from, Ice Prince/ Instagram

Panshak Henry Zamani wey pipo sabi as Ice Prince,na Nigerian hip hop recording artist and actor.

Im become popular afta e release "Oleku", one of Nigeria most remixed songs of all time.

For 1999, Ice say im begin writr rap songs and start dey performing dem for school.

For 2001 im begin record im music.

For one interview wit BBC, di rap artiste say im never set out to become a musician.

Na sake of personal loss and di violent crisis wey im see dey happun on di streets, im begin find solace in singing and rap.

Ice Prince grow up for Jos inside central Nigeria.

For 2002, im and some friends formed di "ECOMOG Squad" but split afta one year.

Na two years later e connect wit some oda artistes wey dme later form one singing group dem call "Loopy Crew".

Since im start im career, Ice Prince don win many ogbonge music awards wey range from Headies, Channel O music award, Future Awards plus many odas.