Kizz Daniel apologize plus explain wetin truly happen for Tanzania

Wia dis foto come from, Instagram/kizzdaniel
Nigerian musician Kizz Daniel don apologize give im fans and pipo of Tanzania and promise to do free show.
Kizz Daniel suppose perform for Summer Amplified Show for Tanzania but no come fit perform sake of' circumstances wey pass im power.'
"I must apologize to di fans. None of dis dey intentional I love my job, especially I love performing, I be great entertainer."
"I no mean to disrespect di fans, e no dey intentional at all."
"I want to perform. I come Tanzania to perform but because of circumstances wey pass my power, we no fit make dat happun."
"I apologize once again to di pipo of Tanzania and I hope say una go give me anoda chance to give una proper and beautiful show."
Di popular Buga singer promise to make up for wetin happun by doing free show dis Friday.
"Regardless of di story, news and press out there, di show go still go on."
End of Di one wey oda users dey read well well
"We don reach agreement to put up a show dis Friday and na free show e go be," Kizz Daniel tok.
On Monday, news and video of kizz Daniel arrest flood social media platforms.
Dis na afta fans wey bin come to see di Nigerian singer perform begin para dey scata things for di show venue as dem no see am.
Dis come make di organisers of di Summer Amplified Show for Tanzania to involve police on top di mata.
Wetin Kizz Daniel say happun?

Wia dis foto come from, Instagram/Kizzdaniel
For one press conference on Tuesday night, Kizz Daniel share im side of di story.
Di popular Buga hitmaker say one agency contact am back home to come perform for Tanzania on di 7th.
"I suppose dey Uganda on di 6th, so I feel okay well, e go only dey nice to drop in and say hello to my Tanzania pipo."
E say di agency tell am say di promoter of di Tanzania show don already book one connecting flight for am to leave Uganda 7th of August to Dar es Salaam, Tanzania."
Kizz say e im comot hotel 6:00am for di airport but ufortunately, di airline for Uganda delay di flight for one hour before dem travel.
By di time dem land Kenya, di connecting flight from there to Dar es Salaam don already leave.
"So we inform di show organizer wetin happun and ask if we go still fit make am to di show as na around 12noon we enta Nairobi."
Di show promoters promise to get di next available flight to Dar es Salaam and kizz Daniel say e wait for over 8 hours for airport inside Nairobi
"Around 8:45pm, we enta plane and fly straight to Dar es Salaam and land there around mid-night."
Kizz Daniel say wen dem land Dar es Salaam, dey find out say di airline forget dia bags and some equipment for Kenya.
Dey inform di show organizer and di airline. Then, di airline promise to get di bags.
And by di time e send im band to di venue of di show to do sound check, angry fans wey don already dey there chase dem away.
Dis bad news no stop am as e contact some Tanzania stylist for cloths for di show.
Kizz also explain how some unresolve issues between di agency back home and di promoter also cause delays.
But by di time dem reach agreement to continue with di show, di fans don vex.
E say dem advise am to stay back for im own safety.
Di Nigeria arstist say police later dey involve for di mata because of di vandalism wey happen for di event venue.
Kizz Daniel add say police no arrest am but invite am questioning relating to di destruction of property.
Wetin di organizer tok
Organisers of di event, Big Step Consultancy apologise give di public ontop wetin happun for di Summer Amplified concert.
Big Step Consultancy say dem pay Kizz Daniel im full money before e fail to perform on 7 Agust, 2022 as dem bin plan.
Dem assure di public and fans wey pay and show up for di event say dem go do all dem fit do to make sure say dem hold every pesin wey dey involve accountable.
And assure dia fans and customers say dem go handle di mata wella.
How Nigeria goment interven for di mata
Nigerians in Diaspora Commission play role for di release of Kizz Daniel afta Tanzania police involve for di incident.
Di commission first confam for social media say, Kizz Daniels dey Oyster Bay Police Station Civil Police for Dar es Salaam, Tanzania.
And add say dem do tok-tok with dia mission to see how to settle di mata.

Wia dis foto come from, Odas
Later, Chairman, Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa announce through her Twitter handle say dem don release Kizz Daniel.
Madam Abbike add say lawyer to Kizz Daniel go report to di station di next day.
How Nigerians dey react?
Mixed reactions na im dey come from Nigerians afta dem don get to know di two sides of di story.
While some Nigerians dey blame di Buga singer say e suppose land for Tanzania earlier like four days before di show.
Odas dey try reason di mata with am for social media.
One twittter user say;
"There’s a little kizz daniel in all of us. Dis Adult thing hard Abeg. I want money and I no really really like working for iam like dat, so I kinda get it."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Who be Kizz Daniel?

Wia dis foto come from, Kizz Daniel/IG
Kizz Daniel na popular Nigerian musician wey dem born for Abeokuta, Ogun state.
E real name na Oluwatobiloba Daniel Anidugbe.
Na 2014 di singer release im debut single, Shoye, G-Worldwide Entertainment label.
Some of im hit songs na 'Woju', 'Yeba' and 'Buga'.
For 2017, afta di wahala wey im bin get wit im den record label G-Worldwide Entertainment dat na afta dem carry am go court on top songs wey im wan release without di company approval, e change im name from 'Kiss Daniels' to Kizz Daniel.
One of im recent song 'Buga' dey ginger many pipo for Nigeria, Africa and di world.










