Highlights from COP27 as leaders begin give dia speech on climate change

Wia dis foto come from, Reuters
Leaders from around di world don begin give speech for di U.N. climate summit for Egypt wey begin on Monday as dem dey try to ginger dem sef to against climate change.
But dia messages on di important points dey different different and dia ideas go clash sometimes sake of unfulfilled promise from di past.
So far, dis highlight of di tins wey di different world leaders dey tok for dia speech.
For opening remark of di COP27 summit, Egypt President Abdel Fattah El-Sisi say di world don dey face from “one catastrophe to anoda” and “di planet don become world of suffering today.”
But e add say kontris go “work hand-in-hand” to tackle “one of di most urgent issues wey di planet dey face.”

Wia dis foto come from, Reuters
Senegal President and President of di Africa Union, Macky Sall, as im address world leaders say, Africa dey push for low carbon development even though di continent generate less dan 4% of di world greenhouse gas.
Sall add say na di pipo wey dey “pollute di most” suppose “pay di most in order comot our planet from dis track of climate crises.
E no get any way wey di world go fit adjust to di increasing disasters wey dey cause suffering around di world, UN Secretary General Antonio Guterres, tok for im speech.
End of Di one wey oda users dey read well well
Guterres stress say e no possible to sweep all di loss and damage “under di rug.”
E warn say “we dey on di highway to climate hell wit our feet still on di accelerator,” e tok.
Di planet don already warm 1.1C since pre-industrial times and science sabi pipo say dem must limit di increase to 1.5C by 2100 to avoid di worst effects.
But experts dey predict say if di world continue wit di current policies e go lead to rise wey go dey as high as 2.8C dis century.

Wia dis foto come from, Reuters
Poor kontri dey push for financial compensation from rich kontris wey dey responsible for most of di historical emissions.
Part of di wahala be say “we get credibility problem, all of us,” former US vice president Al Gore tok as im dey refer to how developed kontris dey hustle for gas from Africa.
Oga Gore say “we dey tok, and we dey start to act, but we no dey do enough.”
Barbados Prime Minister Mia Mottley, say di "di global south remain at di mercy of di global north,"
Mottley continue, say e dey difficult for her kontri to get tins like electric cars and batteries compare to odas.
"Dis world still dey look like e bin be wen e bin be part of imperialistic empire. Di global north dey borrow wit interest rates between 1-4%, di global south at 14%. And den we wonder di partnerships no dey work."
U.S. President Joe Biden go land next week, as well as Brazil new President Luiz Inacio Lula da Silva.
Chinese President Xi Jinping no get plan to attend COP27, but im go send representative to di conference.
India no dey di list, and no representatives from Russia, wey be di target of western sanctions for im war on Ukraine, currently dey di schedule.

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin be Paris Agreement and why e mata?
As kontri of di world meet for COP27 for Egypt, dem dey under pressure to improve di landmark commitments wey dem make seven years ago for Paris.
Di Paris Agreement bin unite almost all di kontris for world - for di first time – for one single treaty to reduce greenhouse gas emissions.
E bin be big moment. Nearly 200 kontris agree for di COP21 summit for 2015 to:
Keep temperatures "well below" 2C above di pre-industrial times and to "pursue efforts" to make sure temperature no rise to 1.5C
Limit greenhouse gas emissions from human activity to di same levels wey trees, soil and oceans fit absorb naturally – wey dem sabi as net zero - between 2050 and 2100
Each country to set im own emission-reducing targets
Rich kontris to help poorer kontris by providing funding to help dem adapt to climate change and switch to renewable energy

Wia dis foto come from, Reuters
Some climate jargon
You get problem trying to understand all di climate terminology? Help dey here…
Greenhouse gas emissions: na release of gases wey dey cause climate change – through di greenhouse effet wey dey trap di sun heat for di atmosphere. Carbon dioxide (CO2) wey dem release from burning fossil fuels or fuel refinery na di most important greenhouse gas.
Methane - natural gas - and nitrous oxide, wey dem dey release from di use of fertilizer, plus odas. Dem dey release dem in small amounts but dey very powerful in warming di atmosphere.
Net zero: In simple terms, reaching net zero mean to get to di point wia you no dey add to di amount of greenhouse gases for di atmosphere.
Dem fit achieve dis by reducing greenhouse gas emissions as much as possible and by balancing any wey remain by removing di equivalent amount - either through natural means, like trees, wey dey absorb carbon dioxide, or through technology. Many countries, like UK, don set targets of reaching net zero by 2050.
NDCs: Nationally determined contributions (NDCs) n aim be di koko of di Paris Agreement.
Each kontri don give commitment to reduce dia own national emissions.













