Climate change dey kill elephants, Kenya tok

Wetin we call dis Video, Climate change killing elephants, says Kenya
Climate change dey kill elephants, Kenya tok
Elephants

Wia dis foto come from, Getty Images

Kenya Wildlife and Tourism ministry say climate change don become bigger kasala for elephant conservation pass poaching sef.

In di past one year, di kontri bin record 179 elephant deaths sake of di drought alias faming wey dey affect di Horn of Africa.

Afta plenti seasons wey di rainfall no make sense like dat, rivers and water pans don dry and grasslands don die finish for game reserves.

BBC tori pesin, Mercy Juma dey do dis report from di Tsavo National Park for Kenyam wey be one of di largest parks for di world.