Oyo no be Anambra or Abuja, Ooni of Ife ex-wife, odas go face law over Ibadan stampede - Makinde

Queen Naomi and Oyo state govnor Seyi Makinde

Wia dis foto come from, Queen Naomi/Seyi Makinde/Facebook

Read am in 3 mins

Oyo State Govnor Seyi Makinde don insist say Queen Naomi Ogunwusi, Oriyomi Hamzat and odas wey chop accuse sake of di stampede wey claim 35 lives for Ibadan gatz face trial.

E yarn dis one for goment house wey dey Ibadan, di state capital, on Monday 6 January

Makinde say pipo don reach out to am say similar incidents happun for oda states for Nigeria, and nobody don go jail.

E say if di entire Nigeria decide say dem no go follow di rule of law, Oyo State no go be like dat.

Makinde pray say such tin no go happun for Oyo State again.

E say no mata how famous di pesin be, justice go dey served. Di govnor add say im no get anytin against bail if court wan grant dem bail.

"You fit grant bail, pending di trial. I no get anytin against am. But di pipo gatz go on trial."

Na at least 35 children die and many more wunjure for one event wey di former queen of Ooni of Ile-Ife, Naomi Ogunwusi, organise for Ibadan.

Dis no be di first time wey Queen Naomi go host dat kain event.

Na evri year she dey run di programme under her charitable organisation, Women in Need of Guidance and Support (WINGS).

Di Oyo State Police Command on Thursday 19 December gbab di former queen and odas sake of di tragedy.

For statement wey dem release, di police tok say na 35 pipo bin die for di stampede.

"So far thirty-five minors don dey documented to don die while six odas dey critically injured and on various medical interventions," di statement tok.

Apart from di ex-queen wey be di main sponsor of di event, seven odas including di school principal also dey police custody.

Di police say dem don transfer di case to di Homicide Section of di State Criminal Investigation Department, Iyaganku and add say na di Deputy Commissioner of Police in charge dey lead di investigations.

Court remand Queen Naomi and Oriyomi Hamzat for prison

Justice Olabisi Ogunkanmi of di Iyaganku Magistrate Court for Ibadan, Oyo State, bin order di remand of former Ile-Ife queen, Naomi Ogunwusi and Oriyomi Hamzat, wey be senior manager of one radio station for Ibadan, for custody.

Di judge also order say make dem remand di oga of one Islamic High School for Bashorun, Ibadan.

Na for Agodi Prison for Oyo State dem go dey until dem hear dia cases again.

Na queen Naomi bin organise di annual food distribution program for no less dan five thousand children for Ibadan, wit di aim to make dis Christmas a happy one for dem.

Na four counts of aggravated assault police sama di suspects, offence wey dey against Section 324 of di 2000 Penal Code.

Justice Ogunkanmi order make di three dey remanded in custody until dem receive advice from di Director of Public Prosecutions.