You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Authorities execute man and im sidechick wey collabo to kill im children
China don execute - take di life of - one couple wey troway two pikin from window of one high-rise building.
Authorities find Zhang Bo wey be di papa of di pikin dem and Ye Chengchen guilty of di murder of di two-year-old girl and one-year-old boy for 2020.
Zhang bin get affair with Ye before im come dump im wife den arrange to kill im pikin.
China Supreme Court call di couple plan say e dey very malicious and dem use "cruel methods".
Dem execute di couple for di south-western city of Congqing for Wednesday.
E neva clear how dem take do di execution, even though most times na lethal injection or firing squad dem dey normally use for death sentence for China.
Di court hear say Zhang start "inappropriate" relationship with Ye without say im tell am say e don marry but Ye still continue with am afta she find out di truth,.
Afta Zhang bin divorce im wife for February 2020, Ye bin still see di two pikin dem as "barrier for her to marry Zhang and burden for dia future life togeda".
End of Di one wey oda users dey read well well
Di court follow hear say Ye continue to dey put pressure on top Zhang to kill im pikin, wey dem bin plan am to look like accidental fall.
For 2 November 2020, Zhang troway im pikin from im house for di 15th floor.
Tori of dia execution start to dey trend for di Chinese social media wey dem call Weibo.
One pesin wey im comment get pass 30 thousand likes for Weibo tok say, "Dem deserve am for dia crime".
Anoda pesin comment say, "hope di pikin dem only get peace and joy for dia next life."
Chen Meilin wey be di mama of di two pikin tok on Thursday say, "nightmare wey don torture our family for ova three years don finally disappear.
Dis death sentence dey come on di same day as anoda high profile execution - Wu Xieyu, wey be ogbonge university student, wey dem find guilty say im use dumbbell - wey dem dey use for exercise - to take hit and kill im mama for 2015.