Wetin next after ICC issue arrest warrant for Netanyahu, Gallant and Hamas commander ova alleged war crimes?

Wia dis foto come from, Getty Images
Judges for di International Criminal Court (ICC) don issue arrest warrants for Israel prime minister and former defence minister, as well as di military commander of Hamas.
One statement say di pre-trial chamber bin reject Israel challenge to di court as dem issue warrants for Benjamin Netanyahu and former Israeli Defence minister Yoav Gallant.
Dem also issue warrant of arrest for Mohammed Deif wey be Hamas leader. Although, Israeli military say e don die for one air strike for Gaza in July.
Di judges say “reasonable grounds” dey say di three men get "criminal responsibility" for alleged war crimes and crimes against humanity during di war between Israel and Hamas.
Both Israel and Hamas don reject di allegations.
What next for Nentayahu, Gallant and di Hamas commander?
Now, e go dey for di hand of ICC 124 member states wey no include Israel or di United States, to decide weda or not dem go enforce di warrants.
For May, di ICC prosecutor Karim Khan bin call for arrest warrants for Netanyahu, Gallant, Deif and two oda Hamas leaders wey don die since - Ismail Haniyeh and Yahya Sinwar.
Although Israel believe say Deif also don die but di chamber say e no dey able to confam im death.
Di prosecutor case against dem include events of 7 October 2023, wen Hamas gunmen bin attack southern Israel and kill about 1,200 pipo and also take 251 odas back to Gaza as hostages.
Israel bin respond to di attack by launching a military campaign to get Hamas, and na at least 44,000 pipo dem kill for Gaza, according to wetin di territory Hamas-run health ministry tok.
Mr Khan accuse di Hamas leaders of crimes against humanity and war crimes including killing of group of pipo, murder, di taking of hostages, rape and torture.
For di Israeli leaders, di accusations include deliberate attacks on civilians, and di use of starvation as a weapon of war, as well as killing of group of pipo and murder.
ICC fit arrest Israel and Hamas leaders?
Di chief prosecutor of di International Criminal Court Karim, na im apply for arrest warrants for Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu and Hamas leader.
E say e get reasonable grounds to believe say di men get criminal responsibility for war crimes and crimes against humanity.
Meanwhile, ICC as a judicial institution no get im own police force or enforcement body.
Dem go get to rely on cooperation with countries worldwide for support, particularly to make arrests, transfer arrested pesins to di ICC detention centre for The Hague, freezing suspects assets, and enforcing sentences.
Although dem no be United Nations organization, di Court get cooperation agreement wit United Nations.
Wen a particular situation no dey within di Court jurisdiction, di United Nations Security Council fit refer am to di ICC to grant am jurisdiction.
Wetin be ICC and which power dem get?
Di International Criminal Court (ICC) na permanent global court wey dem form for 2002.
Di court get di power to prosecute pesins and leaders for genocide, crimes against humanity and war crimes.
ICC no get jurisdiction to look back on di past – e fit only deal wit crimes wey dey committed afta 1 July 2002 wen di Rome Statute, wey establish di court, begin operate.
Di court also get automatic jurisdiction only for crimes wey dey committed for di territory of state wey don confam di treaty; or by citizen of dat kind state; or wen di United Nations Security Council refer case to am.
Na 124 countries don confam di court. Israel and di US neva ratify di treaty.
Di court no get police force of im own to track down and arrest suspects.
Dem rely on national police services to make arrests and den ask for dia transfer to Di Hague.
Scottish lawyer Karim Khan become im chief prosecutor for 2021.









