Who be Hamas leader Saleh al-Arouri wey dem kill for Beirut?

Wia dis foto come from, Getty Images
Saleh al-Arouri na one of di most senior figures for di Hamas hierarchy - a leading man on both di political and military fronts.
Di 57-year-old na im be di deputy head of Hamas political bureau, and im help establish di group military wing, di Izz al-Din al-Qassam Brigades.
Im bin remain deeply involved wit di group military affairs.
Saleh al-Arouri die for one explosion for Beirut southern suburb of Dahiyeh, attack wey dem widely blam on Israel.
Im join Hamas for 1987, and e help establish di group military presence for di occupied West Bank.
Sale al-Arouri na one of di closest connected Hamas officials to both Iran and Iran-backed Hezbollah for Lebanon.
Im don serve time for Israeli prisons. Afta im release im be negotiator in one deal wey see to di release of more dan 1,000 Palestinian prisoners wey dem release in return for di freeing of Israeli soldier Gilad Shalit for 2011.
On 27 October last year di Israeli army bin demolish im West Bank home for di town of Arura, near Ramallah on 27 October. Arouri bin dey live for Lebanon before im die.
End of Di one wey oda users dey read well well
Lebanese media report say im die for Israeli drone attack on Hamas office for di southern Beirut suburb of Dahiyeh, alongside six odas wey report say dem also be members of Hamas.
Dis no be just about who dem kill but where dem kill am. To kill one senior Hamas official for Hezbollah stronghold for Lebanon go make tins even more precarious for a veri volatile junction for di fighting.
Lebanon caretaker Prime Minister Najib Mikati describe di killing as a new Israeli war crime wey aim to drag Lebanon into a new phase of di conflict.
Hezbollah call di attack a "serious assault on Lebanon, dia pipo, dia security, [and] sovereignty" and warn say "dis crime no go pass witout response and punishment".
Izzat Al-Rishq, one member of di Hamas political bureau call am a "cowardly assassination by di Zionist occupation".
Israel military neva comment, as dem tell BBC say dem no dey respond to reports for foreign media.
Israel dey widely reported to commit targeted killings on foreign soil, but rarely comments on cross-border strikes. Mark Regev, adviser to Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, no tok say na Israel dey responsible but im called di attack a "surgical strike" against Hamas leadership.
Di kontri and di wider region now face anxious wait to see how Hezbollah go react, and weda Israel war for Gaza go spill ova into Lebanon.

Wia dis foto come from, AFP
"No be attack on Lebanon or Hezbollah" - Israel tok
Israeli tok-tok pesin Mark Regev stop short of confirming say Israel bin carry out assassination, one standard position for Israeli officials, but im tell MSNBC: "Whoever do am, e gatz dey clear say dis no be attack on di Lebanese state.
"E no even be attack on Hezbollah, di terrorist organisation.
"Whoever do am, do surgical strike against di Hamas leadership. Whoever do am, get kwanta wit Hamas, dis one dey veri clear."
Saleh na di most senior Hamas figure wey dem go kill since Israel go to war wit di group afta dia 7 October attack.
On that day, waves of Hamas gunmen bin invade Israel and attack communities around di border, and kill about 1,200 pipo, mostly civilians, and take around 240 to Gaza as hostages.
Israel bin launched one military offensive in response, wit di declared aim of destroying Hamas.
Since den, more dan 22,000 Palestinians - mostly women and pikin dem - don die sake of Israeli strikes on Gaza, according to Gaza Hamas-run health ministry.
Hezbollah don fire scores of rockets into Israel and fight several skirmishes wit Israeli forces during di Gaza war.

Wia dis foto come from, AFP













