Second Tanzanian student wey Hamas bin hold for Israel don die

Joshua Mollel

Wia dis foto come from, Joshua Mollel

Wetin we call dis foto, Joshua Mollel bin land Israel just one month before di Hamas attack
    • Author, By Wycliffe Muia in Nairobi & Alfred Lasteck in Dar es Salaam
    • Role, BBC News

One Tanzanian student wey dem initially report as part of di pipo wey Hamas take hostage for Israel don die, Tanzania goment tok.

Joshua Mollel bin dey work as agricultural intern for one Kibbutz wey Hamas gunmen bin attack for 7 October.

Tanzania Foreign Minister, January Makamba say di Hamas gunmen kill Mr Mollel immediately afta dem take am hostage.

Hamas also kill im fellow student Clemence Felix Mtenga for di attack.

Di minister say dem don tell Loitu Mollel, wey be Joshua papa about di death of im son.

"We dey plan to take Mr Mollel, anoda family member and one goment official to Israel, to get more information on di mata," Mr Makamba post on X, former Twitter.

Di Mollel family neva comment on di mata.

Inside one Facebook post, authorities for Kibbutz Nahal Oz say Hamas dey hold Mr Mollel deadi bodi.

Di two Tanzanian students bin travel to Israel just one month before di 7 October attack.

Tori pipo bin initially report say dem bin dey among di 240 wey Hamas bin take hostage.

According to Tanzania officials, around 350 Tanzanians dey live for Israel, mostly students wey dey pursue agricultural-related studies.

Dozens of residents of Kibbutz Nahal Oz bin dey among di 1,200 pipo wey Hamas fighters kill on 7 October.

Since den, some 18,600 pipo don die for Israeli operation for Gaza, Hamas tok.

One South African bin dey among di two Tanzanians Hamas kidnap, Israel tok

Foto of some di pipo wey be Hamas hostage

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Israel display foto of pipo wey Hamas carry as hostage enta Gaza, on October 26, 2023 for Tel Aviv

Israel goment bin say two pipo from Tanzania and one from South Africa dey among di 224 hostages wey Hamas bin carry afta di 7 October attacks for Israel.

Dem bin no give any of dia names.

Tanzania authorities bin don confam before say two of dia kontri men dey miss.

BBC bin speak to di family of one of dem, Joshua Mollel, wey be student of agriculture for di kibbutz wia dem bin target.

Gaza

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, IDF don bomb Gaza for 20 days now

Foreigners from 25 kontri na im dey Hamas hand, Israel tok.

Dem make up 135 of di 224 wey dem dey hold - di largest number, 54, na from Thailand.

South Africa authorities neva tok anytin on di tori say one of im kontri man follow among di hostages.

Dem carry dem wen militants from Hamas – wey Israel, UK, US and some oda powerful kontris say dem be terrorist organisation – cross enta Israel from Gaza, kill at least 1,400 pipo.

Israel don revenge since wit air strikes on Gaza, wey di health ministry wey Hamas dey run say don kill more dan 6,500 pipo.