Alban Bagbin return as Speaker of Ghana 9th parliament

Foto of di parliament of Ghana

Wia dis foto come from, Parliament of Ghana

Read am in 6 mins

Alban Sumana Kingsford Bagbin don return as di Speaker of Ghana 9th Parliament.

Bagbin swearing-in don mark di beginning of di legislative session under di Fourth Republic.

Di swearing-in ceremony happun for di inaugural session of di new Parliament early mor-mor of Tuesday 7 January, 2025 for Parliament House in Accra.

Di event follow di dissolution of di 8th Parliament wey shelle for midnight, to signal di transition to a new chapter for Ghana democracy.

Bagbin, bin make history for 2021 as di first Speaker to come from di opposition party. Maybe na why di National Democratic Congress (NDC) renominate am for di role.

Im get ogbonge support during im re-election sake of im experience as a statesman.

8th parliament, di end of a dramatic era

Di 8th parliament go go down in history as di most dramatic and historic parliaments for di kontri.

For dis parliament, for di first time, both di goment party (new patriotic party - NPP) and di opposition (national democratic congress - NDC) get equal number of lawmakers; 137 each.

Dis na wetin sabi pipo bin call hung parliament.

Na so e also get one independent candidate wey win election to become MP, but im decide say im go do business wit di goment party - so dem become 137 + one.

Dat way, di goment party bin get di majority of di 275 MPs wia dem take pass plenty bills and programmes, some of wey di Ghanaian pipo tok say na bad law.

Some of dis na di electronic transaction levy (e-levy) wey dey charge pipo 1.5% on every mobile wallet transaction.

Afta di opposition and oda pipo bin chook mouth for dis mata, di goment finally reduce am from 1.5% to 1%.

Na for dis parliament wey dem introduce 10% tax on bet earnings; dat one too, di young pipo don tok goment say na wrong move but di goment say e dey find money develop di kontri.

During di voting for who go be di speaker of dis 8th parliament on 6 January 2021, di lawmakers don turn di chamber into wrestling ring wia dem don dey fight each oda sake of sakala about whether dem for vote for secret or public.

Na so soldiers don enta di chamber during di fight to stop di lawmakers.

Many pipo bin condemn di behaviour of di lawmakers dat day as dem tok say dem neva try.

For dis parliament di speaker Alban Bagbin and di president Nana Akufo-Addo don exchange letters ova di anti-LGBTQ bill.

Di speaker tok say make di president sign di bill wey parliament bin pass, but di president say im no go sign am.

Di speaker threaten di president say parliament no go approve di president im ministers wia im appoint around dat time.

Even for November 2024, di speaker declare four seats vacant sake of dis lawmakers decide say dem go cross carpet and run for di 7 December 2024 elections as independent candidates.

But di goment party, wey be majority for parliament carry di mata go di Supreme Court wia dem overturn di ruling of di speaker.

Sabi pipo tok say wetin di court do na interference for di work of di legislature.

Las las dis parliament go end wia anoda one go begin, di difference na say di 9th Parliament go have 183 MPs for di NDC wia be di goment party and only 88 MPs for di NPP wey lose di December elections - and 4 independent candidates.

Wit dis majority of 183, di goment party fit to pass any bills and approve any goment business for Parliament sake of dem get majority numbers.

Ghana Speaker Alban Bagbin

Wia dis foto come from, Ghana Parliament/Facebook

Wat next afta dissolution of 8th parliament

Na by 2100hrs (10pm GMT) di process go begin to inaugurate di 9th Parliament.

Wetin go happun be say all 276 MPs wey win di December elections wey di electoral commission don gazette dem, go enta di chamber.

Bifor now, di office of Parliament bin invite di MPs say make dem register as new lawmakers wit dia details.

Na so dia MPs wey register for parliament go enta di chamber to begin di process to elect a new speaker of parliament.

Already, di president-elect John Dramani Mahama don direct im party members for parliament say make dem nominate di current speaker, Alban Bagbin for di role as di speaker of di 9th Parliament.

According to John Mahama, Alban Bagbin "don distinguish imserf for di service of parliament, afta im rise from MP for Nadowli to minority and majority leader bifor im become di speaker of parliament."

John Mahama add say "im dey bring plenti experience to di position wey go dey important to steer di affairs for parliament for dis crucial period of di kontri democracy," di president-elect bin tok for one statement.

Im add say im dey convinced say under Alban Bagbin, parliament go strong well well and deliver di oversight responsibility on di goment.

Wit dis, if di NDC nominate Alban Bagbin for di role of speaker, di opposition wey be di NPP side go also nominate somebody dem wan make im chop di position of speaker of parliament.

Afta dem nominate dia people, di 276 MPs go vote, under di supervision of di clerk of parliament.

Whoever go win di vote go become di speaker of parliament - for dis instance, e dey clear say na di speaker of di 8th parliament, Alban Bagbin wey go win and continue as speaker sake of di goment party NDC wey nominate am, get majority numbers (183) wey go make im win di vote.

Afta di MPs vote for di speaker, im go take oath of office and di chief justice go swear am in to take di position.

Afta im assume di role of speaker wey im sit for im chair, im now go swear in di new 276 MPs-elect

Once dem finish dat process den di 9th Parliament don set and ready to begin work.

Di first job of dis 9th Parliament go be to swear in di new president John Dramani Mahama; dat ceremony go happun on di morning of 7 January 2025, according to di constitution.

Dis year's event don dey happun for di independence square wey di kontri dey expect heads of state and oda ogbonge pipo of ten kontris, wey include president of Nigeria Bola Ahmed Tinubu and president of Kenya William Ruto.

US president Joe Biden don delegate team wia go comot di US to attend di inauguration of di new president on Tuesday 7 January.

Inside one official statement from di White House, President Biden select Shalanda Young, director of US office of management and budget, Virginia Palmer, di US ambassador to Ghana, Karen Bass di Mayor of Los Angeles, Frances Brown, special assistant to di present and senior director for African affairs for di White House national security council.