Afghanistan earthquake pictures: 1,000 pipo die for Paktika province of di kontri

Elderly man react to di destruction wey happun afta one 6.1 magnitude earthquake hammer Paktika province for Afghanistan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Elderly man react to di destruction wey happun afta one 6.1 magnitude earthquake hammer Paktika province for Afghanistan

Afghanistan Taliban goment dey beg for more international help to cope with di ogbonge earthquake wey reports say don kill at least 1,000 pipo.

Di ogbonge 6.1 magnitude earthquake strike near di city of Khost, and as far away as Pakistan and India feel di shakes.

Rescue teams dey run around to save those wey trap under di remains, but efforts dey slowed down by heavy rain, and no enough infrastructure and resources.

One powerful earthquake don kill at least 250 pipo and leave many injured for Afghanistan, one local official don tell BBC.

Fotos wey dem bin share ontop social media show pipo ontop stretchers, rubble and homes wey destroy for Paktika province.

Di quake strike about 44km (27 miles) from di south-eastern city of Khost.

Villagers help di search and rescue operation by going through di remains of one destroyed building for Paktika

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Villagers help di search and rescue operation by going through di remains of one destroyed building for Paktika
Ambulance convoy transport victims of di earthquake for Gayan village by navigating through rocky terrain

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Ambulance convoy transport victims of di earthquake for Gayan village by navigating through rocky terrain
One man dey search for im belongings under di remains afta di earthquake

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One man dey search for im belongings under di remains afta di earthquake
Injured victim of di earthquake dey receive treatment for one hospital inside Paktika as military officers dey look

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Injured victim of di earthquake dey receive treatment for one hospital inside Paktika as military officers dey look
One Afghan boy dey read from di Quran while e siddon next to a body of di earthquake victim as part of burial rite

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One Afghan boy dey read from di Quran while e siddon next to a body of di earthquake victim as part of burial rite
Foto from one village wia di earthquake cause damage

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Survivors and rescuers don tell BBC of villages wey dey almost completely destroyed near di epicentre of di quake