You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cristina Rosi arezzo: Italian woman wake up afta 10 months in coma for daughter delivery
Cristina Rosi, wey be Italian woman don wake from coma afta 10 months, according to local tori pipo.
Rosi, age 37, bin dey seven months pregnant for her daughter wen she suffer heart attack July last year.
Dem deliver her daughter, Caterina, by emergency Caesarean section. But Ms Rosi bin still dey di coma wit suspected brain damage.
She don wake up now and her first word be, "Mamma", na so her husband tok.
"We bin no expect am, na real joy afta plenti suffering," na im Gabriele Succi, tell La Nazione newspaper.
Dem bin don transfer Ms Rosi go one clinic for Austria in April to get specialist care during her recovery.
Both her husband and mother dey her side wen she bin speak.
Na one crowdfunding page bin dey manage pay for her treatment.
End of Di one wey oda users dey read well well
And dem don raise pass €170,000 ($208,000, £148,000) for extra rehabilitation, plus physiotherapy.
"You no go fit recognise Christina now," na im tori pipo Arezzo Notizie news website tok say Mr Succi tok .
"She dey more relaxed, dem remove her tracheotomy [and] thru pump dem dey give her one medicine wey go lead to oda physical progress."
Di couple daughter bin spend some months for hospital due to lack of oxygen during di delivery.