Cristina Rosi arezzo: Italian woman wake up afta 10 months in coma for daughter delivery

[Cristina Rosi arezzo]: "Italian woman 'Cristina Rosi figlia' wake up afta 10 months in coma for daughter"

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Cristina Rosi dey collect treatment in Austria

Cristina Rosi, wey be Italian woman don wake from coma afta 10 months, according to local tori pipo.

Rosi, age 37, bin dey seven months pregnant for her daughter wen she suffer heart attack July last year.

Dem deliver her daughter, Caterina, by emergency Caesarean section. But Ms Rosi bin still dey di coma wit suspected brain damage.

She don wake up now and her first word be, "Mamma", na so her husband tok.

"We bin no expect am, na real joy afta plenti suffering," na im Gabriele Succi, tell La Nazione newspaper.

Dem bin don transfer Ms Rosi go one clinic for Austria in April to get specialist care during her recovery.

Both her husband and mother dey her side wen she bin speak.

[Cristina Rosi arezzo]: "Italian woman 'Cristina Rosi figlia' wake up afta 10 months in coma for daughter" delivery

Wia dis foto come from, Cristina Rosi

Wetin we call dis foto, Cristina Rosi and her husband, couple daughter bin spend some months for hospital due to lack of oxygen during di delivery.

Na one crowdfunding page bin dey manage pay for her treatment.

And dem don raise pass €170,000 ($208,000, £148,000) for extra rehabilitation, plus physiotherapy.

"You no go fit recognise Christina now," na im tori pipo Arezzo Notizie news website tok say Mr Succi tok .

"She dey more relaxed, dem remove her tracheotomy [and] thru pump dem dey give her one medicine wey go lead to oda physical progress."

Di couple daughter bin spend some months for hospital due to lack of oxygen during di delivery.