Woman give birth to 10 babies?: Gosiame Thamara Sithole no born 10 babies according to her boyfriend

"Woman gives birth to 10 babies": [Guateng Gosiame Thamara Sithole] born '10 babies-decuplets in South Africa'

Wia dis foto come from, African News Agency (ANA)

Wetin we call dis foto, Dis na Gosiame Thamara Sithole, one month ago

Di family of one South African man wey im girlfriend reportedly born 10 babies last week don tok for statement say dem no tink say di babies exist until pesin prove dem otherwise.

Last week, local media for South Africa bin report say Gosiame Sithole, 37, bin deliver 10 babies - seven boys and three girls - by caesarean section for undisclosed hospital for di capital Pretoria.

But di family of Tebogo Tsotetsi, tok for statement wey dem attribute to di 'father' say im don confirm to dem say e never see di babies and bin rely on im girlfriend, wey call am to inform am of their birth.

Di statement further claim say Tsotetsi bin make several attempts to visit Sithole and di babies for hospital but she no disclose her whereabouts to am or inform am of di condition of di babies.

Afta di news of di 'birth of 10 babies' come out, tori bin spread say she fit don set new Guinness World record.

Guinness World Records tell BBC say dem dey investigate Madam Sithole case.

One woman wey get eight babies for US for 2009 currently hold di Guinness World Record for di most children wey one woman don deliver at once and wey survive.

Last month, 25-year-old Halima Cissé from Mali give birth to nine babies, wey report say dey well for one clinic inside Morocco.

Most pregnancies wey involve large numbers of babies dey end prematurely, according to BBC Africa health reporter Rhoda Odhiambo.

Multiple births wey involve more than three babies dey rare and often na di result of fertility treatments - but for dis case di couple say dem conceive di belle naturally.

We don review plus update dis tori.