Gosiame Thamara Sithole no born 10 babies, multiple pregnancy cause

South African woman, Gosiame Thamara Sithole wey bin reportedly born 10 babies tori no dey true according to her boyfriend.

Last week, local media for South Africa bin report say Gosiame Sithole, 37, bin deliver 10 babies - seven boys and three girls - by caesarean section for undisclosed hospital for di capital Pretoria.

But di family of Tebogo Tsotetsi, tok for statement wey dem attribute to di 'father' say im don confirm to dem say e never see di babies and bin rely on im girlfriend, wey call am to inform am of their birth.

Most times na di result of fertility treatments fit lead to multiple births.

Expert say multiple pregnancy and birth at once fit occur wen fertility treatment bin dey involved for di case.

Last month, 25-year-old Halima Cissé from Mali give birth to nine babies [nonuplets], wey report say dey well for one clinic inside Morocco.

After seven years of waiting, 39 year old Joyce Akhimien born six pikins[sextuplet]: four boys and two girls on 12 January, 2021 for Port Harcourt, Nigeria.

Similarly, after 21 years of wating' - 49 year old Doris Wilson born Sextuplets on 9 February, 2021 for Bayelsa State, inside di Niger Delta region of Nigeria.

Deaconess Wilson na di mama of Miracle, Mercy, Merit, Marvis, Marvellous and Mirabel, four girls and two boys.

Most pregnancies wey involve large numbers of babies dey end prematurely, according to BBC Africa health reporter Rhoda Odhiambo.

So wetin dey causes multiple pregnancy?

Multiple births wey involve more than three babies dey rare.

But gynaecologist Bill Kalumi, from Kenya's Kenyatta National Hospital, say:

"E dey really only occur wen fertility treatment bin dey involved for di case."

However e get some reasons why pipo dey find fertility treatment.

But most commonly in Africa fertility drugs dey prescribed wen a woman begin dey use hormonal form of contraceptive.

Dis na as she fit find out say e go take a while to ovulate again, Dr Kalumi tok.

E fit then result in di release of plenti eggs, instead of one, during a woman monthly cycle.

Multiple births dey risky for both mother and babies - and a woman wey scan show say dey cari more than four foetuses fit even get advise to reduce di number.

E dey happun in kontris wia abortion dey legal.

Most pregnancies involving large numbers of babies end prematurely, as e bin happun for Ms Cissé case.

And premature babies - those born before 37 weeks - dey at risk of developing problems.

Dis na as dem fit get lungs wey no mature and dey at risk to infections such as sepsis because of dia weak immune system.

Longer term, children wey dem born plenti of dem at once also dey more likely to develop cerebral palsy - which affects movement.

But for Gosiame case, Guinness World Records tell BBC say dem dey investigate Madam Sithole case.

One woman wey get eight babies for US for 2009 currently hold di Guinness World Record for di most children wey one woman don deliver at once and wey survive.

Modern medicine dey already allow women to born children far later in life than dia ancestors.