"Happy Independence Day Ghana 2021": Ghana flag, President independence day messages, wish & fotos celebrating 64 years

Wia dis foto come from, Jubilee House
Ghanaians take to social media to post dia pictures alongside di kontri flag to celebrate Ghana 64th independence anniversary today.
And for im independence day speech today, President Nana Akufo Addo ask Ghana pipo to not just celebrate but put hand together to help goment protect di kontri heritage and environment.

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House
De president of Ghana dey very optimistic say Ghana go be a better place of opportunities as development be progressive since independence.
"We for hand over barton of opportunities not retrogression to our pikins", de Ghanaian leader add.
Ghana na Africa first independent nation dey celebrate 64 years of freedom from de colonial chains.
De 2021 celebration take different twist due to de effect of covid-19.
Instead of de usual gathering of school children at various districts and municipal assembly parks in honour of de historic achievements, dem do dia year's own for de seat of government, Jubilee House wey ebi limited to only de military and government officials.

Wia dis foto come from, Jubilee House
De beautiful event afford de president de opportunity take address de nation.
End of Di one wey oda users dey read well well
He assure every Ghanaian say things go be much better in de years ahead as de records dey show say "Ghana be on positive economic recovery as a lower income economy for three conservative times since en come office."
According to de president, "every Ghanaian for be part of de development make dem bequeath to our children, their children, and generations unborn a nation of hope and opportunity, not one of despair and retrogression."
As de Independence fall for Saturday 6 March, Monday go be officially declared holiday.
Happy Independence Day Ghana 2021 fotos

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House

Wia dis foto come from, Jubilee House
Happy Birthday messages from Ghanaians to motherland Ghana
See what Ghanaians dey talk about dema country as de country dey celebrate 64years:
Dancehall musician Shatta Wale say Ghana be de golden city

Wia dis foto come from, Screenshot
Wife of de president Rebecca Akufo-Addo simply dey celebrate happy independence

Wia dis foto come from, ScREENSHOT
Investigative journalist Manasseh Azure Awuni say "dis be de most hopeless feeling e get" out of all de independence anniversaries e witness.

Wia dis foto come from, Screenshot
Former president John Kufour say Ghana be 64years strong.

Wia dis foto come from, Screenshot
Former Prez. Johna Dramani Mahama say Ghana be de onle one nation dem get and all must work togeda for her growth.

Wia dis foto come from, Screenshot
[Happy Independence Day Ghana 2021] see 10 interesting things you no know about Ghana
Today as Ghana dey celebrate en 64th Independence Anniversary, make we gist you on de top 10 things you no know about Ghana

Wia dis foto come from, Getty Images
1. First country for sub-Saharan Africa to gain independence
Ghana be de first country for sub-Saharan Africa wey gain independence on 6th March, 1957. Today be exactly 64 years since Ghana wrestle dema freedom British colonial authority to manage dema own affairs.
2. Ghana means 'warrior king'
De word or name 'Ghana' dey mean 'Warrior King' inside Mande, Sonike language wey some estimated two million people dey speak across West Africa.
3. Trans-Atlantic trade
Ghana be de center of de trans-Atlantic slave trade. De Portuguese first arrive for Ghana formerly known as 'Gold Coast' around 1471 where dem start to trade plus de local people. Goods like salt gold, spirits, fine cloth den stuff. Later, European powers start dey capture den sell human beings from West Africa into slavery for Europe and America.
4. 'Kente' cloth dey originate from Ghana
Kente dey come from Ghana, oral history from Bonwire, de Ghanaian village wey produce first kente say de cloth dey in existence for 378 years now. In recent years, kente come turn iconic symbol for de Black race across de world.

5. Producers of 'fantasy coffins'
Ghana be de producers of 'fantasy coffins' for de world inside. Ghanaians dey take dema dead relations very serious, sake of that sometimes dem dey manufacture artistic coffins to bury de dead.
Usually de coffins dey represent something which be closely related to de person wey die like en car, profession etc. For instance if career driver die, dem fit create coffin which dey look like car to bury am
6. One war for Ghana last 77 years
De longest war for Ghana against European invaders last 77 years, dis be de Anglo-Ashanti War from 1823 to 1900
De Anglo-Ashanti Wars be five conflicts wey happen between de Ashanti Empire and the British Empire. Dis war bring Ashanti Empire under then British Gold Coast Colony.

Wia dis foto come from, Denis Ivers
7. Ghana get de biggest man-made lake in de world
Ghana get de biggest man-made lake in de world, Lake Volta. De lake dey span over 320 miles, which dey travel from South-western parts of de country to North.
8. Ghanaians dey name children based on day of birth
Ghanaians dey name children based on de day dem born dem. Usually de first names of children of wey dem come from Akan tribes like Fante and Ashanti dey name kiddies based on e day dem born dem. Dem believe say de day get spiritual, social and lifelong influence on parts of de person en life.
For instance a male born on Sunday is Kwasi while de female is Akosua. A male Tuesday born is Kwabena while de female be Abena.
So from Monday to Sunday every child dey bear one name based on de day dem born am.
9. English dictionaries adopt local language 'kwashiokor'
De most popular Ghanaian local language wey dey inside English dictionary inside be, kwashiorkor. Kwashiokor be Ga language which dey describe child wey dey suffer from malnutrition, especially protein.
10. Fastest man in de world to run backwards
De fastest man in de world to run backwards be Ghanaian, Ferdie Adoboe. He set world record for de fastest 100 yard backwards sprint which he complete in 12.7 seconds around 1983.













