John Mahama speech today on Ghana Supreme Court election petition verdict: Mahama reject ruling of March 4 judgement wey favour Nana Akufo-Addo

"John Mahama speech today on Ghana Supreme court election petition verdict"
Wetin we call dis foto, John Mahama speech today for Cantonment, Accra afta de Supreme Court Judgement on 4 March 2021.

Ghana former President, John Dramani Mahama on Thursday evening tell pipo for de west African kontri say dem do everitin to 'frustrate me' for Supreme Court.

Mahama speak for de first time afta de Supreme Court verdict earlier in de day throw out en 2020 election petition in favour of President Nana Akufo-Addo re-election.

Mahama wey be de National Democratic Congress [NDC] Presidential Candidate for Ghana 2020 election, say "our legal team put down our case in a clear manner "

"Much as I dey aware say we dey legally bound to di supreme court judgement, I disagree with de trial and de rulings of di Supreme Court."

"De petition sort to provide opportunity for transparency and accountability in de management of our electoral process. But no one wey follow de proceeding of de supreme court go dey surprise with de judgement pronounced few hours ago."

For de today judgement, de seven-member panel of Supreme Court Judges all take one decision and throw out de election petition wey John Dramani Mahama file.

Supreme Court say dem no get any reason to order re-run of election and dismiss de petition on top say e no get merit.

De Supreme Court be de final court judgement of any dispute for mother land Ghana of about 30 million population.

However John Mahama reject all what de justices of de Supreme Court rule, wen he make speech today for im office.

John Mahama speech today on Ghana Supreme court election petition verdict
Wetin we call dis foto, John Mahama running mate for NDC Prof. Jane Naana Opoku Agyeman wey become de first woman Vice Presidential Canditate for Ghana sit behind Mahama

John Mahama speech today - Oda points e make on de Supreme Court judgement

Oga Mahama quote some part of de kontri law and say e believe say de rule of law suppose be "one rule for all."

E list tins wey Ghanaians go remember as di moment wey de Electoral Commission chairperson dodge scrutiny, request for questioning and odas.

De NDC Presidential candidate say Ghana Electoral Commission [EC] chairperson refusal to testify for de election mata na bad example for di future of kontri/.

Mahama say di Electoral Commission clearly fail to live up to dia moto and e dey worried about how wetin don happun so, go be bad precedent for de kontri.

"While court don give judgement in dis petition, many pipo no fit tok say dem see say court do justice for di petition sake of de constant restriction wey dem put for de petitioner as e dey lay down e case."

Mahama say all dis tins wey happun so na clear stab for de heart of transparency and accountability to de pipo of Ghana and also to de kontri electoral system.

"Ghanaians go always remember dat moment wen my lawyer alias lead counsel, oga Tsatsu Tsikata quote from de holy bible to beg de justices of de supreme court to dey faithful to dia judicial oaths and dia conscience. Only for de lawyer representing de second respondent to argue for de exclusion of God in dis mata."

"And yet for de courts in Ghana including de Supreme Court, we swear on de bible or de cross as we also do with de holy Quran to speak de truth and nothing but de truth."

"Ghanaians go also remember and dis go enta history, dis 2021 election petition for dat big moment wen de chairperson of de Electoral Commission dodge public scrutiny."

"Dem do everything for dis trial to prevent de commission from accounting to de pipo under whose name dem take hold office.

Dem dismiss request for questioning, turn down request for inspection of document in de possession of de commission, ignore request for admission of facts."

"Ladies and gentlemen, de moto of Ghana Electoral Commission na transparency, fairness and integrity. Principles wey de key actors of de Electoral Commission clearly fail to leave up to on dis occasion."

"De refusal to account to Ghanaians don set de worrying precedent and dis dey worry me because e fit allow oda heads of state institution to adopt de approach of non accountability for dia work."

John Mahama speech today on Ghana Supreme Court election petition verdict:
Wetin we call dis foto, John Mahama and running mate for NDC Prof. Jane Naana Opoku Agyeman, as e recognise her during de speech on Thursday.

John Mahama next move afta Supreme Court ruling today in Ghana

John Mahama add say dem go continue to be de voice of de voiceless.

"We go dey law abiding and we no go do anything to compromise de stability of dis kontri.

"We go however continue to be de voice of de voiceless and we no go dey distracted from our goals of demanding justice and fairness for de pipo of Ghana at all times."

E say at de appropriate time e legal team go come out with detailed comments on today judgement.

Mahama advise those wey support am and e party no to give up hope even with di current supreme court judgement.

E also thank all those wey play role for im campaign during de election. Then promise to be law abiding and not to do anything wey go destabilize de peace of de kontri .

John Dramani Mahama add say: "De supreme court don give e verdict but de national debate about de bad state of our democracy and de increasing weakness of our state institution only just begin."

"At de appropriate time de legal team go come out with detailed comments on today judgement."

"E don reach time for us to come togeda to confront those wey wan destroy de very democratic system wey bring dem to office."

"John Mahama speech today on Ghana Supreme court election petition verdict"
Wetin we call dis foto, Dis be where John Mahama and en party de NDC stand address Ghanaians on de outcome of di Supreme Court judgement.
"John Mahama speech today on Ghana Supreme court election petition verdict"

Ghana Supreme Court on March 4 validate de Presidency of Nana Addo Dankwa Akufo-Addo after ruling say en obtain over 50% (51.295%) of total valid vote casts during last years' elections.

Join millions of odas wey dey follow BBC News Pidgin on Facebook and online to watch John Mahama speech.

Oga Mahama bin challenge di December 7 2020 presidential election results wey de Electoral Commission (EC) declare, asking de court to cancel de results of de elections and order a rerun because of alleged irregularities.

But de Supreme court tok say de petitioner, John Dramani Mahama no demonstrate in any way how de errors wey e dey claim say de EC make for de declaration of de presidential election results by de chairperson, Mrs Jean Adukwei Mensa affect de outcome of de election.

"John Mahama speech today on Ghana Supreme court election petition verdict"

Wia dis foto come from, Facebook/@JDMahama

Wetin we call dis foto, John Mahama don serve as president of Ghana for four years before-before.

John Mahama bin claim for de petition say no candidate poll more than 50% of de total valid votes cast as de constitution require and advise di supreme court to look into de mata.

Afta plenti weeks of legal arguments from all de pipo wey de petition involve, de Supreme Court support de EC declaration of Nana Addo Dankwa Akufo-Addo as de truly elected president.