Daddy Freeze and Oyedepo: OAP Ifedayo Olarinde beg Nigerian preacher Bishop David Oyedepo afta viral video wey shake table

Daddy Freeze and Oyedepo

Wia dis foto come from, Screenshot/Instagram

Wetin we call dis foto, OAP Ifedayo beg Nigerian preacher Bishop David Oyedepo for viral video wey shake table
Read am in 3 mins

Daddy Freeze, Nigeria radio broadcaster wey sabi shake table, don openly beg alias apologise to David Oyedepo, di founding Bishop of Living Faith Church, sake of di 'ínsult' wey im give di ogbonge pastor.

Inside one short video ontop im social media page on Saturday night, Daddy Freeze wey real name na Ifedayo Olarinde, say im dey sorry for insulting Oyedepo about two years ago.

Di radio on-air personality also yarn say im no get intention to dishonour and disrespect di 'man of God'.

"My attention don catch one video I release about two years, seven months ago while addressing some important issues wey bin happun back then," Daddy Freeze tok.

"I apologise for di way I take deliver di message and for any insult to Bishop David Oyedepo inside dat video as I bin no plan in any way to dishonour, disrespect or disregard di pesin of di bishop."

"Di way pipo dey look my intention wey no be wetin I mean, dey regretted. My methods of addressing issues wey concern how Christians worship dia God alias doctrine don long since change to a more scriptural and less confrontational approach."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Background of Daddy Freeze and Oyedepo mata:

Daddy Freeze and Oyedepo

Wia dis foto come from, Pastor David Ibiyeomie, Daddy Freeze, David Oyedep

Wetin we call dis foto, Pastor David Ibiyeomie, Daddy Freeze, David Oyedepo.

Daddy Freeze, di popular Nigerian broadcaster wey real name na Ifedayo Olarinde get old habit to always attack popular gospel preachers AKA 'men of God' for di west African kontri.

On Monday September 7, Freeze enta news again afta popular Pastor David Ibiyeomie of Salvation Ministries for Port Harcourt, Nigeria, swear for am. Pastor Ibiyeomie say im no fit dey alive and Freeze go dey insult im 'papa', Pastor David Oyedepo.

David Oyedepo

Wia dis foto come from, Bishop David Oyedepo

Wetin we call dis foto, David Oyedepo na one of di most popular pastors for Nigeria

Bishop of Living faith Church Worldwide wey pipo sabi as "Winners chapel", David Oyedepo also follow for big big pastors wey Freeze don face.

For September 2020, Bishop Oyedepo post for im verified Instagram page say di only way for marriage to dey fruitful na "total submission from di wife".

Daddy Freeze and Oyedepo

Wia dis foto come from, Bishop oyedepo/instagram

Wetin we call dis foto, Bishop Oyedepo statement for Instagram

Freeze counter am say submission na both ways, no be only for woman. Im add say wetin Bishop Oyedepo describe as submission sound like slavery to am.

Daddy Freeze and Oyedepo

Wia dis foto come from, daddy freeze/ instagram

Wetin we call dis foto, Daddy Freeze statement for Instagram

Who be 'Daddy Freeze'?

Di 44-year-old ogbonge broadcaster na pikin to Nigerian papa and Romanian mama.

Daddy Freeze and Oyedepo

Wia dis foto come from, Daddy Freeze

Wetin we call dis foto, Daddy Freezena controversial radio presenter

Im bin grow up for Ibadan, Oyo state for southwest of di kontri wia im also go school for University of Ibadan.

For 1996, Freeze start im radio broadcasting career for Broadcasting Corporation of Oyo State (BCOS), Ibadan before im come move to Cool FM for 2001.

As e be so, pipo for social media don begin hala for Pastor Ibiyeomie sake of di kain harsh word wey im use curse Freeze.