David Ibiyeomie to Daddy Freeze 'insult' viral video, David Oyedepo and oda Nigeria big pastors wey top radio broadcaster don tackle

Pastor David Ibiyeomie, Daddy Freeze, David Oyedepo.

Wia dis foto come from, Pastor David Ibiyeomie, Daddy Freeze, David Oyedep

Wetin we call dis foto, Pastor David Ibiyeomie, Daddy Freeze, David Oyedepo.
    • Author, Ogechi Obidiebube
    • Role, BBC News Pidgin, Lagos

Daddy Freeze, di popular Nigerian broadcaster wey real name na Ifedayo Olarinde get old habit to always attack popular gospel preachers AKA 'men of God' for di west African kontri.

On Monday September 7, Freeze enta news again afta popular Pastor David Ibiyeomie of Salvation Ministries for Port Harcourt, Nigeria, swear for am. Pastor Ibiyeomie say im no fit dey alive and Freeze go dey insult im 'papa', Pastor David Oyedepo.

As e be so, pipo for social media don begin hala for Pastor Ibiyeomie sake of di kain harsh word wey im use curse Freeze.

Dis na three ogbongeNigerian preachers wey Freeze don attack once or many times before.

1. David Oyedepo

David Oyedepo

Wia dis foto come from, Bishop David Oyedepo

Wetin we call dis foto, David Oyedepo na one of di most popular pastors for Nigeria

Bishop of Living faith Church Worldwide wey pipo sabi as "Winners chapel", David Oyedepo also follow for big big pastors wey Freeze don face.

For September 2020, Bishop Oyedepo post for im verified Instagram page say di only way for marriage to dey fruitful na "total submission from di wife".

Bishop Oyedepo statement for Instagram

Wia dis foto come from, Bishop oyedepo/instagram

Freeze counter am say submission na both ways, no be only for woman. Im add say wetin Bishop Oyedepo describe as submission sound like slavery to am.

Daddy Freeze statement for Instagram

Wia dis foto come from, daddy freeze/ instagram

2. Chris Oyakhilome

Chris Oyakhilome

Wia dis foto come from, Chris Oyakhilome/youtube

Founding Pastor of Christ Embassy, Chris Oyakhilome also chop yabbing from Freeze during dis coro era.

Freeze wey call di pastor disappointment, say im teachings on di goment and 5G dey dangerous.

Inside one YouTube video wey Pastor Oyakhilome release, im claim say federal goment order lockdown for Lagos and Abuja because dem wan install 5G network.

3. Chris Okotie

Reverend chris okotie

Wia dis foto come from, Reverend chris okotie/facebook

Pastor of popular Lagos church and political aspirant, Reverend Chris Okotie enta di same trouser wit Freeze for August, 2020.

Daddy Freeze bin tackle di pastor sake of one unverified message wey claim say Okotie no gree reopen im church for worship unto say im members no fit wear face mask as goment order. Di message claim say Okotie say for pipo to wear mask go church mean say dem dey deny di work wey 'Christ finish for di cross'.

Freeze say for Okotie to even assume say one building na di church, na di same tin as to deny di work wey Christ finish for di cross. Freeze quote plenti Bible verses for di live YouTube broadcast to counter di pastor.

Who be 'Daddy Freeze'?

Di 44-year-old ogbonge broadcaster na pikin to Nigerian papa and Romanian mama.

Daddy Freeze latest news on Hushpuppi arrest

Wia dis foto come from, Daddy Freeze

Im bin grow up for Ibadan, Oyo state for southwest of di kontri wia im also go school for University of Ibadan.

For 1996, Freeze start im radio broadcasting career for Broadcasting Corporation of Oyo State (BCOS), Ibadan before im come move to Cool FM for 2001.