Beyonce Black is King: Wow moments from di award winning musician visual album

Wia dis foto come from, Facebook/ Beyonce
American singer, Beyonce don release her new visual album, Black is King ontop Disney+.
Di visual album wey Beyoncé, write, direct, and produce, feature plenti ogbonge artist like JAY-Z, Kelly Rowland, Naomi Campbell, Tina Knowles-Lawson, Lupita Nyong'o, Shatta Wale and odas,
Di visual album highlight "di journey of Black families, throughout time" and tell di tori of "one young king journey through betrayal, love and self-identity.
"Black Is King na confirmation of one grand purpose, wit ogbonge visuals wey celebrate Black resilience and culture. Di feem dey highlight di beauty of tradition and Black excellence," Disney tok for statement about di feem.
For di feem, you see dance sequences, Lion King samples, and footage of Black families around di world wit sequences of Beyoncé for beach, dey recite details of one generations to anoda.
According to one press release, Black Is King "na di lessons of Di Lion King for today's young kings and queens wey dey search for dia own crowns"
Check out some of di clips wey go give you goosebumps
Di 'Awww' sister-best-friend-moment between Beyonce and Kelly Roland for inside di video clip of Brown Skin girl
Trust Beyonce wit di "power" break dance. She give us back-to-back energy dance for inside di video of 'My Power'
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Some fans bin categorise 'Find your way Back' video as one of di best visuals effect from di 'Black is King' album.
For video wey she shoot mostly for desert area, Di powerful visual transition showcase di African and Black culture.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Blue Ivy wit Beyonce serving di mama and her daughter adorable moments from one of di clips.
Who say Beyonce no sabi leg work? Check out di Zanku moves and the arts for 'Already' video wey she feature Ghanaian musician, Shatta Wale
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Dat blue dress! JayZ and Beyonce collaboration for music video dey always torori and dem no disappoint dia fans for dis one.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Popular Nigerian dancer and video vixen, Kodak wey die from electric shock feature for one of di videos before she die.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
Plenti pipo go agree wit dis fan tok about Nigerian artist, Yemi Alade!
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 6












