Iran plane crash: "Evidence dey show say Iranian missile shoot down Ukrainian aircraft" - Trudeau

Wia dis foto come from, AFP
Western leaders say evidence dey to suggest say na one Iranian missile maybe by mistake bring down di Ukrainian passenger plane wey crashed near Tehran.
Di leaders of Canada and di UK want full and thorough investigation into di crash, wey kill all 176 pipo on board.
Iran don say no be missile strike by dia air defence cause am.
Di crash happun just hours afta Iran carry out missile strikes on two US forces airbase for Iraq.
"Dis wan further point say serious investigation dey needed," Trudeau tok. "Canadians get questions and dey deserve answers."
But di prime minister also say e too dey early to start to dey blame anybodey or conclude, e refuse to talk too much about di details of di evidence.

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
US media bin don dey tok-tok say di time di plane crash suggest say dem fit don mistake di plane as US warplane as Iran bin dey prepare for US to revenge di missiles dem fire give dem.
CBS News quote US intelligence source say dem say satellite detect some kind of infrared "sound" of two missile wey dem launch, followed by anoda sound of explosion.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile, Newsweek quote Pentagon and senior US intelligence officials, as well as an Iraqi intelligence official, say dem say dem believe say na one Russian-made Tor missile hit di Ukraine International Airlines flight PS752.

Wia dis foto come from, AFP
US President Donald Trump tok on Thursday say e dey "suspect" wetin happun to di plane.
As tension full ground ontop afta US kill top Iranian general Qasem Soleimani on 3 January, Iran don say dem no go hand over di black box flight recorders to Boeing, di plane wey manufacture di plane or even America sef.
Meanwhile, Iran Foreign Ministry don invite Boeing to take part inside di investigate to find out wetin cause di crash.
Under global aviation rules Iran get di right to lead di investigation, but di manufacturers suppose involve too.
Iranian TV later show say dem don bulldoze di crash site.
A total of 63 Canadians naim bin dey di flight, along with plenti odas wey bin wan fly to Toronto from Kyiv.
UK Prime Minister Boris Johnson also tok like Mr Trudeau say Britain dey work closely with Canada and oda international partners wey dey affected by di crash.

Wia dis foto come from, AFP
Meanwhile, Newsweek also quote US and Iraqi officials say dem tok say dem believe say na Russia-built Tor M-1 surface-to-air missile system na im hit di aircraft.
Wen tori pipo ask President Donald Trump wetin im tink, im say: "I dey suspect something. Na something very tragic, na tragic tin. Somebody fit don mistake on di oda side."

Wia dis foto come from, EPA
Earlier on Thursday, Oleksiy Danylov, di secretary of Ukraine security and defence council, tok for Facebook say dem dey conside three oda tins wey cause di crash.
- mid-air collision with drone or anoda flying object
- engine destruction/explosion due to technical reasons
- explosion inside di plane as a result of terror attack
Meanwhile Iran Civil Aviation Organisation (CAOI) chief Ali Abedzadeh say: "Di plane, wey bin dey head west to leave di airport zone, turn right afta e get problem and bin dey head back to di airport as at di time e crash."












