Iran plane crash: Ukraine International jet with 176 pipo don crash

Pipo stand near wetin remain afta di Ukrainian plane crash near Imam Khomeini airport inside Tehran on January 8, 2020

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Nobody survive di crash

One Ukrainian Boeing-737 with 176 pipo onboard don crash for Iran, according to local tori pipo.

Di aircraft wey belong to Ukraine International Airlines crash just afta take-off from Iran Imam Khomeini airport inside Tehran, according to di Fars state news agency.

Tori be say di plane bin dey fly go di Ukrainian capital of Kyiv.

Ukraine embassy for Tehran first say na engine failure cause di crash but dem later remove di statement.

Map of crash site

Ukraine President Volodymyr Zelensky say im dey cut shut im visit to Oman to go Kyiv. E don draw ear say make pipo no carry dey assume wetin happun until official report come out.

"My sincere condolence to di relatives and friends of all di passengers and crew," im tok inside statement.

Who bin dey on board?

Among di victims na 82 Iranians, 63 Canadians, 11 Ukrainians including all nine crew, 10 Swedes, four Afghans, three Britons and three Germans, Ukrainian Foreign Minister Vadym Prystaiko tok.

Ukrainian officials say 169 passengers na im buy tickets for di flight but two no later board.

Ukraine airline plane

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tori be say di plane bin dey go di Ukrainian capital of Kyiv. (Di foto na file image)

Ukraine International Airlines don suspend flights wey dey go Tehran indefinitely, di airline say na Monday dem schedule di aircraft last for maintenance.

Although dem send rescue teams go di site of di crash, Iran Red Crescent organisation say di chance say dem go find any survivors no dey.