You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Donald Trump shout na wa! Ontop African girl wey dey jog ball like fire
Read am in 1 mins
One viral video of one African girl wey tie wrapper dey jog ball, don make US presido Donald Trump open mouth, shout.
Di president use im twitter account, comment ontop di video wey don de trend for days now. Im use only one word - Amazing, take describe am.
Twitter pipo neva sure which African kontri di girl come from, but everi kontri go wan claim her as dia own, wit di kain thing she dey carri ball do.
Oga Trump na pesin wey dey like use twitter, but dis hailing im give di girl shock many pipo.