You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
UK don tell Roman Abramovich to prove say im money dey clean
United Kingdom don tell Russian billionaire wey also be di owner of Chelsea FC, Roman Abramovich, to prove give dem say im money dey clean if e wan enta back to dia kontri.
UK goment don step up dia vex against Russian big boys, wey dem dey call oligarchs, because of di poisoning case of Sergei Skripal and im daughter wey happun for Salisbury.
And one of di first pesin wey dis dey affect na Abramovich, wey no get anoda choice but to watch im club FA cup final from Russia.
Di Financial Times report say Abramovich investor visa, wey bin allow am to fit enta UK don expire and as e be now, e dey under di class of new applicant wey want UK visa.
Abramovich worth like £9.3billion but im go need to prove say at least £2million of im investment for UK come from legal sources under new rules to fight against 'dirty money'.