You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Willian don make Chelsea fans vex
Read am in 1 mins
Chelsea fans dey para for social media for Willian afta di Brazilian post one picture of di FA Cup win.
Willian post foto for im Instagram as di team dey celebrate dia FA Cup win, im come use cup emoji cover di place wey im manager Antonio Conte stand.
No so fans vex say na big disrespect to Conte.
Di Brazil player relationship with im manager get as e be for some time now afta im drop from di starting eleven come begin dey sidon for bench.
For di final, na di last minute im enta as dem win Manchester United 1-0.