Nigeria presidential election: Jennifer Efidi, woman inside viral video wey dem batter her face for polling unit tell her tori

Some thugs attack Bina Jennifer as she wan cast her vote
Read am in 4 mins

"I go my polling unit, di queue dey long so I join di queue afta I don check di verification list and I see my name, I find somewhere sit down to wait for my turn. Den I hear gunshot."

Na so Madam Bina Jennifer Efidi tok as she narrate wetin happun wen she go vote over di weekend for di presidential and parliamentary elections.

Fotos of Madam Bina Jennifer Efidi wit her bloody and battered eyes for her polling unit for Lagos state, as she dey cast her vote bin trend over di weekend. Pipo bin dey hail and encourage her determination to come back to vote despite say she suffer attack.

For dis exclusive interview wit BBC Pidgin, narrate to BBC how di mata take happun and why she go back go vote even afta di incident.

'I hear di sound of gunshot'

Bina Jennifer Efidi
Wetin we call dis foto, Some thugs attack Bina Jennifer as she wan cast her vote

Efidi tok say di experience na wetin she no expect as di polling unit no far from her house and dem no dey record violence for di polling station.

"I go my polling unit, di queue dey long so I join di queue afta I don check di verification list and I see my name, I find somewia sit down to wait for my turn.

"Afta sometimes, some group of boys waka come wia we queue, dem dey di opposite side of wia I siddon dey tok, dem later comot. Meanwhile, di voting process still dey go on smoothly.

"E no tey like 30 minutes later, I just feel one huge impact on my face like say dem throw me sometin, Instantly, I hear gunshot, I tink say dem shoot me, say gun hit me. Pipo dey run to hide, I just hold my face and I feel blood dey flow for my hand. I dey shout for help but pipo just waka pass me.

"I gatz waka go one compound, na one lady wey dey live for my street come later help. She bin use handkerchief to apply pressure for di place wey blood dey gush comot. We dey shout for help, but pipo dey run dey try close dia doors.

I later enta pesin room and dem say make I call my husband but I dey fear make dem no go harm my husband as di boys still dey shoot. She carry me go anoda compound, pipo dey try stop di bleeding. Na some brave men later carry me go one nurse for di street to help stop di bleeding."

Efidi add say sake of di plenty blood wey she don lose and she don dey weak, her husband later carry her go hospital for proper medical attention.

Dem stitch her for four to five places as di cuts dey very deep and give her injections and medicine.

Nigeria election graphic

'Why I go back to cast my vote'

BBC

"I know say my vote fit make a difference and I want make my vote count."

Dis na wetin Efidi tok afta she return from hospital wit her battered face and she still go cast her vote afterwards.

She say as she comot for house, she see say pipo still dey vote as normalcy don return to di area.

"Even wit my bruises and pain, I still wan cast my vote. I just get will and determination to vote". She add.

Efidi say she dey disappointed wit di development because security officials no dey dia polling unit as thugs come destroy di exercise,

"Dem throw away ballot boxes, maybe if security agents dey, e for make dem fear but na only us dey."

She say dat one still no stop dem wey get passion, wey see am as responsibility to vote.

How pipo react

Many pipo don describe Edifi as heroine afta her encounter for di hand of Jaguda pipo for her polling unit on election day.

Dem condemn di attack and hail her bravery to still go ahead and cast her vote wit di injury.

Efidi say she don receive calls from many Nigerians within and outside di kontri wey show concern since di incident happun.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Efidi add say if her preferred candidate no win, even afta di stress she pass through she no mind as dat na God will.

But if her candidate win, she no say plenty tins go change for beta for di kontri.

Who dey di race to run tins for Nigeria?

Learn more about Nigeria presidential candidates

Choose a candidate to view dia bio

Bola Tinubu

All Progressives Congress (APC)

  • Age: 70.
  • Im study accounting for Chicago State University.
  • Two-term Lagos State Governor from 1999-2007.
  • Im represent Lagos West for Senate from 1992 to 1993.
  • Na veteran of Nigerian politics, dis na im first presidential bid.
  • Campaigning against military rule.
  • Im grow Lagos State annual revenue by more than four times from N22.2 billion for 1999 to N220.9 billion for 2007.
  • E work as senior auditor and later treasurer of Mobil Producing Nigeria, one of di kontri largest oil producers.
  • Im plan to boost Nigeria export and reduce reliance on imports.
  • Im plan to cut youth unemployment rate in half within four years and create one million jobs for ICT in two years.
  • Reform di justice system to focus on crime prevention and improve trust in security forces.

Atiku Abubakar

Peoples Democratic Party (PDP)

  • Age: 76.
  • Vice President of Nigeria from 1999 – 2007.
  • Im get Master's in international relations from Anglia Ruskin University, UK.
  • Im be former customs officer wey come into politics for early 1980s.
  • Five unsuccessful presidential bids in 1993, 2007, 2011, 2015 and 2019.
  • Im found di American University of Nigeria, wey offer scholarship to freed Chibok girls.
  • Na successful businessman with investments in oil services, agriculture, banking and pharmaceutical sectors.
  • Controversial privatisation of goment assets agenda.
  • Im plan to give private sector greater role in di economy.
  • Reinforce national unity through equity, social justice amongst Nigeria diverse pipo.
  • Im plan to restructure Nigeria governance system.

Peter Obi

Labour Party (LP)

  • Age: 60.
  • Two-term Governor of Anambra State from 2007 to 2014.
  • Na Presidential running mate during di 2019 election.
  • A business man, im study philosophy for University of Nigeria, Nsukka.
  • Im establish sub-sovereign wealth fund wey worth about $156million in dollar-denominated bonds by di end of im tenure as governor.
  • Im move Anambra from 26th to 1st in di ranking of best performing states for NECO and WAEC national examinations.
  • E own chain of retail business wey don create thousands of jobs.
  • Im plan to ensure accountability in governance and fight corruption.
  • Im plan to move Nigeria from consumption to production.
  • Prioritize Human Capital Development through robust investments for STEM education, health, and infrastructural development.

Rabiu Kwankwaso

New Nigeria Peoples Party (NNPP)

  • Age: 66.
  • Minister of Defence from 2003 to 2007.
  • Kano State Governor from 1999 to 2003, and 2011 to 2015.
  • Im represent Madobi Federal Constituency for House of Representatives for 1992 and Kano Central Senatorial District between 2015 and 2019.
  • Im get PhD in civil engineering from Sharda University, India.
  • Scholarship and philanthropic efforts.
  • Im increase di primary school enrolment figures from one million in 2011 to over three million in 2015 wen e leave office.
  • E introduce free school feeding and uniforms for primary school pupils.
  • Im establish Kano University of Science and Technology in Wudil and di Northwest University, wey be Kano first and second state universities.
  • Im plan to create jobs through investment in agriculture.
  • Address insecurity.
  • Respect di rule of law and follow due process.