Anambra governorship election result 2021: Charles Chukwuma Soludo of APGA win - See breakdown of im victory

Collage of some of di candidates

Wia dis foto come from, Other

Di Independent National Electoral Commission don declare Prof. Charles Chukwuma Soludo, di winner of di Anambra state govnorship election.

Soludo win 19 out of di 21 local goment area for Anambra state and get 112,229 votes to defeat di oda candidates.

Meanwhile, PDP come second with 53,807, APC get 43,285, while YPP get 21,261 votes.

INEC declare Soludo winner afta dem bin suspend announcement of result and pause di process of declaration of di winner of di state govnorship election result until supplementary election hold for di 326 polling units inside Ihiala local goment area.

Di returning officer Prof. Florence Obi bin say e dey important to complete di election for Ihiala local goment based on constitutional provision wey say candidate must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di LGAs within a State for Governorship election.

Di supplementary hapun on Tuesday, 9, November, 2021.

Di returning officer explain say dem bin no fit deploy well to di local goment due to security concerns.

She add say e dey important for Ihiala local goment election to hapun for di 326 polling units for Ihiala before dem go fit conclude di election.

Di collation and announcement of di results of di Saturday governorship election bin start for Inec headquarters for Awka around 11:30 am on Sunday 7 November, 2021.

Di Independent National Electoral Commission, INEC na di umpire for di process and na dem declare di winner.

According to INEC, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election na di simple majority of votes cast.

Dis wan mean say di winner must win di one quarter, (25%) of di votes cast for two third of di States of di federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).

Nigeria dey operate di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions.

Map wey show how di parties/candidates perform for di election

Rank

Party logos

According to INEC, di total registered voters na: 2,466,638, while total accredited voters: 253,388