Anambra state election: Inec say wetin go happun if pipo no come out to vote, observe sit at home on voting day
Wia dis foto come from, INEC Situation room
Anambra State pipo dey prepare to vote for who go be dia next governor on 6 November, 2021. But di build-up to di election don come with some palava.
Top among dem na di concern weda pipo go gree come out on di day to exercise dia right to vote, sake of di activities of di insecurity for di region and initial calls by di Indigenous People of Biafra for pipo to boycott di election.
Dis call na part of di group demand for Nigeria goment to release dia leader Nnamdi Kanu wey dey Nigeria secret police hand.
Di Independent National Electoral Commission don tok wetin go happun if voters no come out to vote.
Inec chairman professor Mahmood Yakubu for statement wey BBC Pidgin use eye see say, if voters no come out on di day of election Nigerian laws cover dat kind scenario.
For Nigeria, di requirements to declare winners for Presidential and Governorship election include
Simple majority of votes cast.
Spread wey be one quarter (25%) of di votes cast for two third of di States of di Federation (for Presidential election) or of di LGAs within a State (for Governorship election).
Prof Yakubu say "Ours [dat of Nigeria] na di first-past-di-post system irrespective of voter turnout and no be di 50%+1 voter turn out for some jurisdictions. So irrespective of turnout, if di results meet di two thresholds, we go declare winner" of di election."
So wetin di Inec chairman tok mean say, if people no come out to vote because of fear of sit at home or dem no just wan go vote. Nigeria law already don make provision for such situation.
Wetin we call dis foto, How tins be for popular Unizik junction for Anambra
Two weeks ago, di proscribed separatist group - Ipob - bin warn say election no go happun for Anambra until Nigeria goment release dia leader.
Di group bin declare five days sit at home wey go start from 5th November, 2021.
But on Thursday 4 November, 2021 di group backtrack. Dem later cancel di sit at home order, come urge Anambra pipo to go vote for Saturday election.
Wetin we call dis foto, Some shops dey closed for Awka, Anambra state
Meanwhile Nigeria police bin also quickly counter di call by di banned group as Deputy Inspector-General of Police, Zaki Ahmed wey dey lead di security team for di election don quash di Ipob call for sit at home.
DIG Ahmed assure Anambra pipo say di police "don make adequate provision of security" and promise say "unprofessional conduct from di police before, during and after di election no go dey."
Wetin we call dis foto, Even some hotels for di state dey closed because of fear of going against sit at home order by di banned Ipob
Despite dis reassurance, BBC Pidgin don observe say pipo for Anambra state still no trust di police like dat as many shops still dey closed and roads dey deserted.
Anambra Gubernatorial Candidates
Profession: Medical Doctor
Age: 62
Godwin Maduka come from Umuchukwu for Orumba LGA of Anambra state.
He study and work for USA before e join di Anambra gubernatorial race.
Profession: Accountant
Age: 58
Etiaba Bennet Chukwuogo become di AA flagbearer afta im defection from APC for July 2021.
He come from Ezekwuabor, Otolo-Nnewi.
He be di oldest son of di first female govnor for Nigeria history, Dame Virgy Etiaba.
He be chairman of di Institute of Chartered Accountants of Nigeria, United Kingdom District from 2002 to 2004.
Profession: Businessman
Age: 55
Nwankwo Wilson Chidozie come from Oko for Orumba North LGA.
He become di AAC flagbearer afta im defection from APC afta e fail to secure di govnorship ticket for September 2021.
He be industrialist wey specialise in providing building materials for different locations for Nigeria and West Africa.
Profession: Politician
Age: 59
Akachukwu Sullivan Nwankpo come from Okija, Ihiala LGAin Anambra state.
He bin previously served as special adviser on Technical Matters to former President Goodluck Jonathan.
E be aspirant under APGA, before e defect go ADC.
Age: 51 -He come from Amichi in Nnewi South LGA.
He served as former President Goodluck Jonathan’s youth leader for Anambra state for the 2015 General Election.
E be member of Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG).
Profession: Health Insurance professional and politician
Age: 62
Emmanuel Andy Nnamdi Uba bin do govnor of Anambra state for only 17 days for 2007 before di Supreme Court of Nigeria remove am put Peter Obi.
He be Special Assistant on Special Duties and Domestic Affairs to former president Olusegun Obasanjo.
He come from Uga, Aguata LGA for Anambra state.
Profession: Economist
Age: 61
Charles Chukwuma Soludo na govnor of di Central Bank of Nigeria from 2004 to 2009.
Di no be im first attempt to run for govnor of Anambra state. for 2010, e lost to Peter Obi wen e dey under di PDP. Im 2013 under APGA lead to im disqualification by di APGA screening committee.
He come from from Isuofia, Aguata LGA.
Profession: Retired soldier and architect
Age: 63
Col. Geoffrey Okwudili Onyejegbu (RTD) come from for Ekwusigo LGA for Anambra state.
For 2010, e run for office of di Anambra state govnor. He also run for di Anambra south senatorial seat for 2018 but e fail to secure a seat.
Profession: Philosopher
Age: 50
He come from Umuokpu, Awka South LGA.
He be di Vice Chairman of di College of di Immaculate Conception (CICOBA), Enugu.
Profession: Engineer and publisher
Age: 47
Chika Jerry Okeke bin previously run for office of govnor of Anambra state for 2013 and 2017.
He contest for seats for di Federal House of Representatives for 2015 and for di Anambra state House of Assembly for 2019 but e fail both times.
He come from Ezinifite, Aguata LGA
Profession: Political Economist, Entrepreneur
Age: 55
Okonkwo Obiora Francis come from Ogidi, Idemili North LGA for Anambra state.
He be trader for Onitsha before e go university of Russia go study.
Profession: Businessman
Age: 50
He come from Okija in Ihiala LGA.
Profession: Real Estate Manager, Business Administrator
Age: 45
Afamefuna Victor Ezenwafor na di APC candidate for di Aguata II State Constituency for di Anambra House of Assembly for 2019 but fail to secure di seat. E defect go NRM for March 2021.
He come from Ekwulobia, Aguata LGA for Anambra state.
Profession: Accountant, Business Executive
Age: 50
He come from Amesi, Aguata LGA.
Valentine Ozigbo bin previously work for di banking and hospitality sectors.
He dey passionate about bringing development as e dey responsible for some developmental projects around Nigeria.
Profession: Traditionalist
Age: 45
Nwawuo wey many pipo sabi as Igwe Ayaya bin try contest for govnor under di AA ticket, before e defect go PRP.
He come from Nando, Anambra East.
Profession: Lawyer, Businessman
Age: 58
Uzoh Obinna Chukwudum Godwin run for gubernatorial office under NDP for 2003. He apply for di same office for 2013 but fail to secure di PDP flag, e try once again for 2017 but fail to secure di APC ticket.
He come from Umunnamehi, Ihiala in Ihiala LGA for Anambra state.
Profession: Businessman
Age: 50
Ifeanyi Patrick Ubah run for Anambra gubernatorial elections under LP for 2014 and lost. For 2019 e contest and win di Senatorial seat of Anambra South under YPP.
He come from Umuanuka in Otolo, Nnewi North LGA.
Profession: Political Economist, Entrepreneur
Age: 55
Okonkwo Obiora Francis come from Ogidi, Idemili North LGA for Anambra state.
He be trader for Onitsha before e go study for one university for Russia.