Muhammadu Buhari UK trip: Nigeria President plan for COP26 world leaders summit

President Muhammadu Buhari travel out of Abuja on Sunday to Glasgow, Scotland.

Di Nigerian leader dey go attend di 26th Conference of Parties [COP26] of di United Nations Framework Convention on Climate Change.

President Buhari dey expected to tok about Nigeria key priorities and action to tackle climate change on Tuesday, November 2 during di COP26 summit.

Im go also tok about di progress on di west African kontri movement to low carbon economy in line wit achieving di Paris Climate Agreement.

African and oda world leaders dey attend di all important climate change summit wey begin today inside Glasgow, Scotland.

Dis waka dey happun shortly afta di Nigerian leader return from Saudi Arabia wia e go attend one investment summit.

From Glasgow President Buhari go travel to Paris, France on official visit.

Na to return di visit wey French President, Emmanuel Macron bin make to Nigeria, and also attend di Paris Peace forum 2021, di fourth edition wey French President dey host.

Di peace Forum 2021, na for Heads of State, Govments and CEOs of major multinationals, as well as several civil society actors, to find solutions to di challenges wey COVID-19 pandemic don cause, and to improve global governance in times of COVID-19.

Dis summit go focus on more solid and inclusive recovery by addressing di various gaps for global governance, wey go offer action for the post-COVID world.

While di President dey Paris, Nigerian govment go organize di Nigeria-Paris Forum.

Di event dey expected to pull a crowd of Nigerian and French investors, goment and business leaders, diplomats and di media.

To showcase opportunities on both sides as well as bringing enlightenment on di prevailing security, economic and investment climate for Nigeria.

Expectations for dis COP26 event dey high.

But wetin e be exactly, who dey go, and wetin dey at stake? Read on for all you need to know about di latest round of climate change tok-tok.

Wetin be COP26?

COP - short for Conference of di Parties - na annual summit wey dey bring together 197 kontris to discuss climate change and how nations - and all of us - dey plan to tackle am.

Na part of di United Nations Framework Convention on Climate Change - one international treaty wey kontri and territory sign by for di world wit di hope say dem go limit di impact of human activity ontop di climate.

COP26 go be di 26th gathering since di treaty start for 21 March 1994. Dis year e go happun for Scotland largest city, Glasgow, between 1-12 November.

How important COP26 be?

E dey very important.

COP26 go be di first summit wey go look back ontop di kain progress wey we don make - or fail to make - since di Paris Climate Agreement wey dem sign for 2015.

Di agreement, wey also dey known as di Paris Accord, na humans game plan to avoid climate disaster.

Dem don recognise say if global warming kontinu as e dey go, as e dey rise past 1.5C above di temperatures we bin get for pre-industrial times, many of di changes to di planet go dey irreversible.

So for di Paris hustle - COP21 - dem set key goals for all of us all make we avoid serious climate change. All di signatories bin pledge to:

  • reduce greenhouse gasses,
  • boost renewable energy production,
  • keep di global temperature increase to "well below" 2C (3.6F) wit aim to limit am to 1.5C (2.7F), and
  • commit billions of dollars to help poorer kontries deal wit di impact from climate change.

Dem also agree then say every five years, dem go review di progress dem don make. Di first one bin suppose happun for 2020 at COP26, but due because of di coronavirus pandemic, dem gatz move to 2021.