You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
President Muhammadu Buhari return to Nigeria afta UK medical trip'
Read am in 1 mins
Nigeria President Muhammadu Buhari don return to Nigeria after e go do medical check-up for London, United Kingdom.
Oga Buhari wey comot im kontri on 30 March, do about two weeks for dia.
Im land for Abuja international airport on Thursday, 15 April, 2021.
Dis latest Buhari UK healthcare waka na di 12th one wey im don go since e become president in 2015.
Before e comot, di 78-year old leader follow meet with di service chiefs [ogas at di top of di Armed Forces] before e enter plane travel last month.
Di announcement of Oga Buhari return appear ontop Nigeria goment Twitter handle.