Plateau State Assembly Speaker impeached: Why lawmakers remove Abok Nuhu Ayuba

PLATEAU STATE HOUSE OF ASSEMBLY

Wia dis foto come from, Hon. Nan'anlong Daniel

Plateau State Assembly lawmakers don impeach di Speaker, Abok Nuhu Ayuba, BBC Pidgin fit confirm.

Dem comot di speaker early mor-mor on Thursday morning and replace am wit di member wey dey represent Pengana Constituency, Yakubu Sanda.

Majority leader, Hon. Na'anlong Daniel wey confam di development to BBC Pidgin say:

Di speaker dey removed sake of accuse of alleged financial recklessness, im high handedness.

Daniel add say Abok no dey participate for goment functions, e no dey carry odas along, plus oda allegations.

Na 16 out of di 24 members of di house wey impeach am for petition dem sign and debate on 28 October, 2021.

Abok Nuhu Ayuba impeachment: Why we impeach Plateau Assembly Speaker - Leader

PLATEAU STATE HOUSE OF ASSEMBLY

Wia dis foto come from, PLATEAU STATE HOUSE OF ASSEMBLY

Wetin we call dis foto, Heavy security dey for di Plateau State House of Assembly

"Since August dis year, di house neva seat sake of level of high-handedness of di Speaker wey don refuse say di govnor no go present di 2023 appropriation bill before di state house of assembly."

E add join say na two-third members of di lawmakers wey consist of PDP and APC na dem agree to remove di speaker for di floor of di house.

Di leader clear air say no be ambush impeachment as dem follow wetin di law tok, wey na to get 2/3rd members of di house.

Profile of di impeached Plateau Speaker - Abok Ayuba

Impeached Plateau state speaker

Wia dis foto come from, ABOK AYUBA/TWITTER

Abok Nuhu Ayuba na Nigerian politician wey dey elected Speaker of di 9th Plateau State House of Assembly for 2019.

Di 35 year immediate-past Speaker na first time member of di state house of Assembly wey dey represent Jos East Constituency.

E be 500 level Law student for di University of Jos when e dey elected.

Im election as di Speaker of di house at di age of 33 na wetin many pipo hail as welcome development as e be representative of di youth.

One former Deputy Speaker of di House from Jos North, seconded by a first-time member of di house, Esther Dusu wey dey represent Jos Norh-West na dem nominate am for Speakership.

Na one ranking member of di assembly wey don dey di house since 1999 na im pipo reason go become speaker but members of di house bin wit one voice elect Ayuba as dem wave all speakership electoral requirements to allow im emergence.

a first-time member of the house, Esther Dusu representing Jos Norh-West. A ranking member of the assembly who had been in the house since 1999 was widely rumoured to emerge speaker but members of the house unanimously elected Ayuba waving all speakership electoral requirements to allow his emergence.