Jos curfew today: Armed gunmen attack make Plateau State government impose curfew

Security agents

Wia dis foto come from, Getty Images

Less dan one week afta serious violence happun for Plateau state, central Nigeria wey lead to loss of lives and several arrests, anoda round of violence don shele for di state.

Dis latest incident don make Plateau State government re-impose 24-hour curfew for Jos North Local Government Area.

According to di state Governor Simon Lalong, di 24-hour curfew go start from 4pm on August 25 until further notice.

Eyewitnesses bin say armed gunmen enta one community like around 8pm on Tuesday, August 24, burn houses and shoot anybody wey dem see.

Di attackers spoil di bridge wey dey enta Anaguta community to stop anybody to get help before dem start di attack.

Yakubu Sani wey dey for Yelwan Zangam area of Jos say for Wednesday morning anoda fight break out for di area.

According to Yakubu many pipo don die for dis latest one but e no fit confam di number.

Some local tori dey report say e pass 35 pipo wey die for di attacks. Tori pipo Reuters also dey report say na 36 pipo die for di night raid.

At di time of dis report, BBC no fit independently verify di total number of casualties but for one hospital, we count 15 dead bodies.

Mr Dan Manjang, di commissioner of information for Plateau confam di attacks, but follow say di number of pipo wey die no dey clear and investigations dey happun.

"Dis criminals just start to kill pipo and burn houses dem also destroy one wooden bridge wey connect to one of di villages so dat security pipo no go fit cross." Dis na wetin Mr Manjang tok.

E add say dem don arrest 10 pipo from di palava wey happun and investigation still dey on.