Latest news in Nigeria: How bandits launch deadly attack on Nigerian Defence Academy

Latest news in Nigeria: How bandits launch deadly attack on Nigerian Defence Academy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian Army soldiers

Bandits don attack di Nigerian Defence Academy [NDA] for Afaka barracks Kaduna state, North west Nigeria.

Tori be say di armed bandits kill two officers and kidnap another officer.

One official wey dey inside di college wen di attack happun also confam di tori to BBC Pidgin.

Eyewitnesses say di incident happen on Tuesday morning wen bandits catch di sojas unaware.

One staff wey dey work for Nigeria Defence Academy confam tori say:

Di bandits attack di military facility, kill and kidnap some pipo.

Nigeria Defence Academy don also release statement confirming say dem lost two men and one kidnapped.

Latest news in Nigeria: How bandits launch deadly attack on Nigerian Defence Academy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigerian Army soldiers

According to di staff di incident happun around 3am on Monday midnight breaking Tuesday.

And dem hear gunshots but think say na training dey go on but early in di morning di situation become clear.

"About 3 am na im we start to hear gunshots but for my mind since na NDA I dey I just assume say na one training or something."

E add say at di moment security pipo don surround di place and dey investigate wetin happun.

Nigeria Defence Academy bandit attack: How e happun

Di management of Nigerian Defence Academy confam say di armed bandits attack di barracks.

Major Bashir Muhd Jajira, di Academy Public Relations Officer for statement on Tuesday say di attack happen for midnight.

"Di security architecture of di Nigerian Defence Academy dey compromised early di morning by unknown gunmen wey gain access into di residential area within di Academy for Afaka.

"During di unfortunate incident, we lost two personnel and one was abducted.

"Di Academy in collaboration wit di 1Division Nigerian Army and Air Training Command as well as oda security agencies for Kaduna state don commence pursuit of di unknown gunmen within di general area wit a view to tracking dem and rescue di abducted personnel.

"Di NDA community and Cadets dey safe for dia Academy. We assure di general public say we go soon apprehend dis unknown gunmen and rescue di person wey dem abduct."