Burna Boy 02 arena: Damini Ogulu AKA Burna Boy concert space ship for London stun fans

Wia dis foto come from, BURNA BOY/INSTAGRAM
Damini Ogulu AKA Burna Boy arrival for 02 arena dis weekend dey 'burst' many Nigerians brain.
Di Grammy award winner stage im very first headline concert for di biggest entertainment arena for London on Friday.
Di singer and songwriter wey be di latest artist to hold concert for di O2 Welcome Back show series bin land for di arena inside space ship.
As plenty pipo enta social media to hail dis new level of entrance, Burna Boy tweet say, "you think say e easy for space."

Wia dis foto come from, DELE MOMODU/INSTAGRAM
Di ogbonge musician shut down di arena as plenty pipo turn up to watch im performance.
Also for di concert, Burna Boy allow young musicians like Rema, Ruger and Omah Lay to shine wit dia songs.
E say dia performance make am dey emotional.
As UK begin open up im public spaces afta lockdown sake of coronavirus.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di O2, from August go begin host some of di biggest and most anticipated shows.
Burna Boy "Twice As Tall" concert wey happun on Friday night na one of dem.
Im Twice As Tall event na one of di Welcome Back Show series wey dem hold to celebrate as society return to normal afta di pandemic.

Wia dis foto come from, DELE MOMODU/INSTAGRAM
Headlining show na one of di goals every musician dey hope to achieve, na validation say di artist don try well-well.
Di 02 arena na one of di exclusive venues wey dey give artists global platform to dey celebrated.
E get indoor capacity of 20,000 pipo plus di ogbonge stage don witness ogbonge artists like Prince, Celine Dion, and some ogbonge Nigerians.







![Milk Crates challenge ["the crate challenge"]: Whats up with the milk crates and Death warning - Pictures and video screenshot](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/0A2B/production/_120230620_milkcrateschallenge-thecratechallengewhatsupwiththemilkcratesanddeathwarning-picturesandvideoscreenshot.png.webp)







