Mercy Johnson wedding anniversary wit Prince Okojie inside fotos on social media

Wia dis foto come from, Mercy Johnson/Facebook
Mercy Johnson and her husband Prince Okojie 10th wedding anniversary tortori many pipo.
Despite di many stories of celebs wey dey divorce or even cancel engagement, dis Nollywood actress keep her home-front kampe.
On Friday Mercy Johnson beautiful fotos of her family ontop her verified Facebook page to mark dia special day.
"What more can I ask for Lord, You don do me well Jesus....Happy Wedding Anniversary to us...."
"10 years of grace, love, forgiveness, understanding, sacrifice, tolerance, patience, respect and friendship."
Na so di 37-year-old Nollywood actress write for her social media page.
Nollywood actress, Mercy Johnson Okojie and her husband, Prince Okojie, on Friday celebrater 10th year of marriage with beautiful photos.
Di celebrity cook also share beautiful fotos of dia four children.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I love you without question Odi; unconditionally. I go waka dis road with you over and over again. Happy Wedding Anniversary to us."
Na di words Mercy Johnson take celebrate her husband.
Mercy Johnson wedding anniversary: Fotos

Wia dis foto come from, Mercy Johnson/Facebook

Wia dis foto come from, Mercy Johnson/Facebook

Wia dis foto come from, Mercy Johnson/Facebook

Wia dis foto come from, Mercy Johnson/Facebook
You fit also like dis video of Mercy Johnson:















