Covid - manifestation anti pass sanitaire: France say vaccinations dey mandatory

Wia dis foto come from, Reuters
All health care workers for France must dey fully vaccinated against Covid-19 by September.
Or dem dey at risk of not collecting dia salary, di government announce.
Di requirement wey many see for French as "manifestation anti pass sanitaire" apply to doctors, nurses, office staff and volunteers.
President Emmanuel Macron also say from next month, pipo go need show health passes to access public places.
Places like shops, bars, cinemas and long-distance train journeys for Franc go require dis health pass [manifestation anti pass sanitaire].
Di pass go show if di holder don collect di jab, or get a recent negative test.
"I dey aware of wetin I dey ask una, and I know say una dey ready for dis commitment, dis part, in a way, of na sense of duty."
Di French president tok for televison address on Monday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin be dis mandatory vaccine?
Di mandatory vaccinations go apply to anybody wey come in contact wit vulnerable pipo.
Therefore e apply to everyone wey dey work for hospitals, clinics and care homes, regardless of dia role.
Dem must dey vaccinated by 15 September or dey at risk of not collecting dia pay, Health Minister Olivier Véran tell France LCI television.
Already dem dey use health passes to enter some venues, like nightclubs wey just reopen for di first time ova di weekend.
However dem go soon expand am to include more places including festivals, theatres and hospitals from 21 July.
And e go apply to those wey dey over 12 years old.
Na to encourage pipo to get di jab, PCR covid tests wey dey currently free dem gatz pay for am now for, unless e come wit doctor prescription.
After di president announcement, Doctolib, di website wey pipo dey use to book dia jabs, crash.
Dis na as so many pipo bin dey try to secure dia appointments.
Cases dey rise for France, sake of Delta variant wey don cause increase in hospital admissions.
On Friday, one panel of scientists wey dey advise di French goment on health matters warn of a fourth wave in di coming months.
And say as many as 95% of pipo fit need vaccination to control di spread.
But, na only a little over half of the population don receive diaa first dose and less than 40% don collect two shots.










