South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wetin we call dis Video, Police fire rubber bullets in an effort to discourage looters

At least 72 pipo don die in side violence wey don spread across parts of South Africa.

Deadly riots don dey ground since di kontri former President Jacob Zuma hand himself into police last week.

Almost 1200 pipo don chop arrest inside di unrest wey begin as protests greet Zuma jailing on Thursday.

But protest turned violent over di weekend, with fires set, highways blocked and businesses looted.

Di rioters don do pass wetin police fit control across di rainbow nation.

South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, Other

South Africa looting updates: Protest in South Africa lead to looting, riots

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Burned out cars inside downtown Joahnnesburg

Di protest in South Africa begin wen pipo begin frown against Jacob Zuma jailing.

But e don turn to looting plus riots and spread and go far across di rainbow nation.

Images from Durban, in KwaZulu-Natal, wey be Zuma home province, show as pipo rush in to loot shops.

South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Police don accuse pipo say dem dey take advantage of di unrest

Dem ransack one supermarket, according to reports.

Na di same tin wey happun ova di weekend, wit violence spreading to di city of Johannesburg.

On Sunday, protesters wey carry sticks, golf clubs and branches march through Johannesburg central business district.

Video footage show as pipo dey set businesses on fire.

Wetin we call dis Video, Dis shopping centre inside Durban dem burst enta guluguluma di place on Sunday.

Inside Johannesburg, footage show looters dey take televisions, microwave ovens and clothes.

Na last week di katakata start afta Zuma surrender himself to begin one 15-month sentence.

Dem kill pipo and arrest several odas.

More fotos from protests and looting in South Africa

South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, AFP VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Looters don dey clear shops inside Katlehong township, east of Johannesburg - Inside dis foto, pipo dey japa from police as dem carri goods while dem dey loot and scata di Lotsoho Mall in Katlehong township, East of Johannesburg, on Monday July 12, 2021
South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Looters empty one store of goods insde di Springfield Value Centre during protest for Durban, South Africa, 12 July 2021.
South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, One man dey japa as e hide im face wen police open fire with rubber bullets towards looters wey dey vandalise di Lotsoho Mall inside Katlehong township, east of Johannesburg, on Monday July 12, 2021. -
South Africa looting updates: Protest in South Africa lead to looting, riots

Wia dis foto come from, EPA

South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, One Johannesburg Metro Police Department (JMPD) officer dey waka between burnt cars for one car showroom inside Jeppestown, Johannesburg, on July 11, 2021.
South Africa looting updates: Protest in South Africa lead to looting, riots

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One burnt out truck dey beside di road following protests linked by police to former president Jacob Zuma"s imprisonment, inside Mooi River, South Africa, July 10, 2021
South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, A supporter of ex President Jacob Zuma during di ongoing violent clashes inside downtown Johannesburg, South Africa, on Sunday 11 July 2021.
Riots today in Johannesburg: Looting for South Africa as Jacob Zuma appeal jail sentence

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Na last week di katakata start afta Zuma surrender himself to begin one 15-month sentence. Dem kill pipo and arrest several odas.
Riots today in Johannesburg: Looting for South Africa as Jacob Zuma appeal jail sentence

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Supporters of former South African President Jacob Zuma block di freeway with burning tyres for one protest inside Peacevale, South Africa, July 9, 2021.
South Africa looting updates: Protest, looting, riots in South Africa as Ramaphosa deploy military - Fotos

Wia dis foto come from, AFP VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, A member of di South African Police Services (SAPS) dey aim at looters following di anyhow looting and vandalism outside di Lotsoho Mall in Katlehong township, East of Johannesburg, on Monday July 12, 2021.

Cyril Ramaphosa address: South Africa leader order military deployment

"Wetin we dey witness now na opportunistic acts of criminality, with groups of pipo wey dey instigating chaos merely as a cover for looting and theft,"

Na so President Cyril Ramaphosa tok for im address on Monday night.

"E no get bad blood alias grievance or political cause wey fit justify di violence and destruction wey we don seen in parts of KwaZulu-Natal and Gauteng."

President Ramaphosa order di immediate deployment of military to to stop di deadly violence wey don break out for some parts of di kontri.

Di leader of di rainbow nation also warn say di kontri dey at di verge of food and medication insecurity.

President Cyril Ramaphosa add say wetin dey happen wit di attack on public and private property na act of criminality.

South Africa President Cyril Ramaphosa address di Nation 12 July, 202

Wia dis foto come from, SABC

Wetin we call dis foto, South Africa President Cyril Ramaphosa address di Nation 12 July, 2021

Di Jailing of former president Jacob Zuma bin deadly riot wey worst yesterday

At least six pipo na im don die and nearly 500 dey arrested since Zuma present imself give police last week.